Plasings

Wys tans plasings vanaf 2022

Merry Christmas to una

Prent
WakaComeTv  We say Merry Christmas to everybody we dey torchlight our waka on top we Blog online, as we dey waka, no be lie. 

ABUJA, KADUNA train go open Monday, 5th of December, 2022

Prent
 Tori As We Dey WakaCome: According to di statement, di train stations go open from 6:30 for morning on Monday, 5 December, 2022 and na only two services dem go dey run for now “di first train go comot from di Rigasa train station for Kaduna state to Abuja by 8:00am in di morning. From Abuja, di first train go leave di Idu train station to Kaduna state by 9:45 for morning” E tok. Di Railway Corporation also tok say dem don get new security measures. One of di measures na for passengers to present dia National Identity Number (NIN) and valid Boarding Ticket before dem go allow dem to enta di train. Di statement tok say to buy ticket now by proxy go only dey allowed for minors and a specified number of adult passengers. You fit buy tickets online and you fit use you mobile app buy ticket too from 8' 0 clock on Sunday morning 4, December, 2022. Residents of Abuja and Kaduna for north central Nigeria fit start to travel wit train services again. Di Nigeria Railway Corporation (NRC) say

Gunmen kidnap person inside mosque for Funtua, Katsina State, northwestern Nigeria.

Prent
 Tori As We Dey WakaCome: Gunmen kidnap person inside mosque for Funtua, Katsina State, northwestern Nigeria. jaguda pipo open fire and kidnap almost twenty worshippers on Saturday night wen Muslim worshippers gada for prayers. Nigerian police tok-tok pesin for Katsina state, Gambo Isah tell yan say di Imam of di mosque and one oda worshipper wound - But dem don discharge dem from hospital afta dem collect treatment. Oga Isah tok say a combined team of police, di military and local vigilante bin immediately rescue some of di pipo dem kidnap. Im say 13 pipo still dey miss. E add say dem dey make efforts to track down di suspected kidnappers and rescue di pipo wey di gunmen kidnap. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsAp

Nigeria president waka go meet with King Charles III

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Nigeria president waka go meet with King Charles III for di first time since e climb di throne. Na on Wednesday President Muhammadu Buhari  meet di new King of England, King Charles for Buckingham Palace, United Kingdom. We presided dey for London on a two-week trip for “im routine medical check up.” Presidential toktok pesin, Femi Adesina say presido go return back to Nigerian on di second week of dis November. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page. Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top twitter @wakacometv You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv  If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com As we dey waka, no be lie.

Wife of di man wey burn I'm stepchildren yan di tori as e take happen.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Wife Of Di Man Wey Burn I'm Five Stepchildren - My Husband Try To Run Away With Di Twin We Get Togeda Madam Esther Ojo narrate how e happun tok say her husband bin come home dey vex and later go buy petrol keep for house, tell am say e dey carry am go work di next day. mama of di five children wey dia stepfather allegedly set on fire for Ondo state , Esther Ojo say her husband bin don first tok say im no want make di children stay wit am. Authorities for Ondo state southwest of Nigeria confam say dem arrest di 54-year-old man afta im allegedly set ablaze im five step children on Friday night. Three of di children die sake of di fire while two dey collect treatment for one goment owned medical facility for di area. Police tok tok person for di state Odunlami Funmilayo, tell Tori pipu say di pikin wey die bin burn beyond recognition. Madam Esther Ojo say dem bin dey sleep for night around 3am wen one of her pikin wey dey about 1

Nigeria Court tell Oga of EFCC make him go relaxed for prison

Prent
Tori As We Dey WakaCom Di EFCC oga bin tok as in dey answer questions from tori pipo afta im budget defence session with lawmakers for di House of Representatives yesterday 8th of November 2022. Im say im organisation go make sure say di law, di provisions take im full course. Oga Bawa still tell tori pipo say dem don recover plenti proceeds from crime dis year. "We don get quite a lot of proceeds from crime and di provisions of Coker tok say make each relevant agency open confiscated and forfeiture accounts, we don open am and we dey remit evritin wey belong to Federal Goment into dat account. We dey also pay victims of crime from dat recovery account". EFCC oga also add say di Commisssion need more more for di new EFCC Academy wey go help dem dey ahead of di criminals through training nad re-training. "We dey build a brand new EFCC Academy and we need funding for am, last year dem allocat Three billion while dis year nothing nothing, na why we d

UK self dey plan waka do strike dis November

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Dis na big suprise As Oyinbo self dey plan to waka strike dis month of November, University lecturers and other staff for inside obodo oyibo - UK,  do plan dis waka.  Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

APC campaign Ogun state

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Di main roads for inside Abeokuta, the Ogun State capital, bin block on tuesday,  as e be say members of the All Progressives Congress (APC) bin do campaign for the presidential candidate of the party, Bola Tinubu and for Governor Dapo Abiodun, wey dey ginger for reelection. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Gunmen Attack Anambra Police Checkpoint

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Plenty pipu fit don kaput , as e be say gunmen attack Anambra police checkpoint around 10:30 am between Ihiala-Uli axis inside Ihiala local government area.  Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Nigerian Abuja Kanu train waka

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Di Abuja/Kaduna Train Service go resume this month  November 2022 Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Asuu Strike - Lecture dey para on top half salary for wey Gov pay dem.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Lecturers dey live life of struggle', Asuu tok afta goment pay 'half salary' Tori waka come out on Thursday say federal goment pay lecturers half salary for di month of October. Goment neva give reason for di payment wey dem make to di lecturers wey suspend dia almost nine month old strike for di same month. NaFriday 14 October dem suspend di strike and resume on Monday 17 October - "federal goment don reduce academic workers to daily paid workers," na so one lecturer tok. Dr Austen Sado, di National Investment Secretary of di Academic Staff Union of Universities (Asuu) for interview yan say dem dey disappointed in goment. Oga Sado wey be member of di National executive council of Asuu say part of wetin lecturers dey complain of na poor salary wey goment dey pay dem compared to how politicians dey collect plenty money. E say e no make sense say on top of di poor salary dem dey collect, goment still get m

Nigeria President yan onto food matter

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Waka enter farm! If you dey hungry, No bi small matter Ontop food waka wey make we Nigeria President Muhammadu Buhari yan dis matter. He still talk say, he dey aware say flood don scatter scatter some farmlands this season but say we still dey sell rice made in Nigeria, and e fit to feed all of us. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Nigeria Minister of education don waka say him no like di sex education inside school.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Federal government don come dey order Nigerian Educational Research and Development Council (NERDC) to remove sex education from children curriculum for school. The Minister of Education, Malam Adamu Adamu, naim give the direction for inside Abuja. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

66 yrs PaPa Wey Kill Him Pikin, waka bury her inside shallow grave inside Akwa Ibom

Prent
 Tori As We Dey WakaCome: Na Di Picture of Di 66 year old man wey allegedly kill im daughter bi dis. Olopa for Akwa Ibom State don arrest di 66 years old man wey kill im 20years old daughter, Di Tori Wey Waka Come be say dis 66 years old man waka kill him 20 years old daughter after dem bi get wan fight,  inside compound wey she go hold im papa plocus dat wan wey oyinbo dey call manhood as dem dey fight. Di na why her papa use stick to hit her for head and she kon die. inorder to hide wetin im do, dis man come bury her for shallow grave inside dia family compound, olapa yan say dem don waka bring out di dead bodi of di girl and dem go do autopsy on am. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send yo

Nigerian Security waka with we Nigeria Security civil Defense Corps

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Di Nigeria Security and Civil Defence Corps wey be (NSCDC) yarn say all efforts dey on ground to remove insecurity for inside the country.  The Commandant General of NSCDC, Ahmed Audi come out dey yarn say Ogbonge Government dey work hard. When dem bin dey yarn for inside Abuja, na for there Oga Audi, con dey tell all the brotherly and sisterly dem for inside we country obodo Naija, say make una no dey listen to some kind talk wey dey rub sand-sand for the effort of ogbonge government based on say dem dey work hard to fight against insecurity for inside we country. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey

Bola Ahmed Tinubu wey bi di APC Presidential candidate waka give pipu money for delta state

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Presidentiatial candidate of the All Progressive Congress(APC) wey em name na Bola Ahmed Tinubu, plus the party’s governorship Candidate for inside Delta State wey em name na Sen, Ovie Omo-Agege don donate #200 million to people wey flood don affect for inside Delta State. Tinube bin donate #50 million cash, while Omo-Agege give #150,000 million worth of relief materials. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Nigeria Airport - Air line don waka end dier strike

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Di Air Transport Services Senior Staff Association of Nigeria (ATSSSAN) don end their strike against Bi-Courtney Aviation Services Limited (BASL) based on say dem sake 34 of their members dem without due process. Mr Frances Akinjole, Deputy General Secretary  of the union naim yarn say the union end their strike after when the Ministry of Labour & Employment, the Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA), the Federal Airport Authority ( FAAN), the Nigerian  Airspace Management Agency (NAMA) and other airport security agencies bin do a meeting inside Lagos. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka,

Nigerian Youth Service Corps

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Di National Youth Service Corps (NYSC) don come dey tell the brotherly and sisterly dem for inside we country say make dem no mind some kind informate for ontop social media wey dey ask coppers for akpalakpala to do their deployment, posting and the rest…say na some kind bad people wey wan fraud people.   NYSC Spokesperson, Eddy Megwa naim yarn dis one on Monday for inside one statement wey dem carry come out for inside Abuja.  Any informate wey you need, visit all the NYSC social media platforms . Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Indian olopa arrest 28 years old man

Prent
Tori As We Dey WakaCome: India olopa don waka arrest one 28-year-old sake of say him molest, plus to do by force minimini- wanawana(rape) to fit enter di place of one small dog.  One 61-year-old wey be say naim dey ginger for animal rights naim fil the complain. for inside one video wey dem send to the man, for the the man dey do the do to the six-month-old dog.  As the matter take be, Last year for the same place, a dog wey im name na Nuri, naim one man too bin rape. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Fire inside Lagos

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Another fire don shele again inside Tejuosho textile market inside Lagos. Wetin cause the fire, never dey clear.. . . This one just dey happen as Fire bin burn one person and wunjure seven other people today as fire go catch for inside bank for Lagos. The bank na four- storey building wey dey for Plot 1114, Adeola Odeku Street, by Eletu Ogabi Close, Victoria Island. . . Meanwhile 1st November last year(2021) na Ikoyi building collapse wey kaput plenty people. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Dem Shoot American Rapper, Takeoff For Houston

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Tori waka come we ear say dem dom shoot American Rapper, Takeoff For Houston  Dem don shoot and kill American rapper Takeoff, from di chart-topping band Migos, for Houston, accord to wetin US media dey report. Olopa tell tori pipu for Variety magazine say dem kill di rapper for one bowling alley wia im bin dey play dice wit im uncle and bandmate, Quavo, on Tuesday morning. Di star, wey im real name na Kirshnik Khari Ball, be 28 years old. Migos na one of di most influential groups of dia generation, pioneering a style of rapping for choppy, staccato triplets wey pipo sabi as di "Migos flow". Di band, wey split earlier dis year, don gbab plenti international hits including Bad and Boujee, Versace and Walk It Talk It. Di shooting happun at about 02:30 local time (07:30 GMT) for one balcony outside di 810 Billiards and Bowling Alley. Olopa say 40 to 50 guests bin dey one private party wen one pesin open

Lagos Bus Driver on strike - Governor beg for meeting to see them on Wednesday.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: No be small gbege as pipu bin dey stranded for bus stop inside lagos, for early mor mor of today wey bi Monday 31st of October  2022, based on say commercial bus drivers under the umbrella of the Joint body Drivers’ Welfare Association of Nigeria (JDWAN) bin start seven-days strike because of anyhow extortion wey government officials dey do them. On dis strike waka, na so di transportation money waka come up...as pipu con dey pay plenty money to fit waka go dem destinations.  From Ijaiye to Oshodi wey be N400, before don  increase to N700 While transport money From Ijaiye to Agege waka come up to N400 instead of N200 naira. As E Dey Hot On top Dis Transportation waka  The Lagos State Government don call the ogas dem for Joint Drivers Welfare Association of Nigeria, JDWAN, to do meeting on Wednesday, 2nd of November so that dem go fit find solutions to everything wey dem dey ginger for. dis na di list of pipu wey do dis. Strik

Nigeria Navy waka with NAPTIP Rescue 50 girls from Ashawo Trafficker pipu hand.

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Di Nigeria Navy on top water don waka rescue 50 women from ashawo waka, on top dis matter as e dey hot, dem don arrest 3 pipu wey dem dey suspect say na ashawo International waka, dat wan wey oyinbo dey call sex traffickers inside Port Harcourt. Lt.-Cdr. Richard Iginla, Base Information Officer, Nigerian Navy Ship (NNS) Pathfinder, do did waka to rescued dis victims for PH city on Sunday. Iginla yan say did waka join body with Nigeria Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) and the Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC). According to Iginla, inside Dis 50 Ashawo teenage girls follow dey inside wey dem  rescued, early mormor on Saturday. Dem yan say na with di help of NAPTIP, wey give dem dis information, because dem self don dey do investigation on top di matter, with small pikin of  14 years of age. Na 50 young girls dis traffickers forced into ashawo work, that wan wey oyinbo

Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball for penalty shootout

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  On top we sport waka with Nigeria Under 17 women. We Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball wey make we kuntry win Germany for bronze medal  We Nigeria’s U-17 Women’s team, Flamingoes give Germany wotowoto on top penalty, we dem use collect bronze medal inside dis FIFA U-17 Women’s World Cup sport waka, dem give 3-2 dem give Germany ontop penalty we dem play. We Nigerian Flamingoes bin dey 3 goals before Germany waka draw with dem, na dis draw we dem two enter make dem play penalty. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Danfo Bus for lagos Go waka Protest on Monday, dem go Boycott work - Dis na why

Prent
Tori As We Dey WakaCome: All di commercial driver for lagos state don yan  say, dem go waka for seven days protest. According to dem, Na sake of allegations of plenty extortion by di management of parks and garages wey dey inside di south west state. Dem waka come with di Joint Drivers' Welfare Association of Nigeria (JDWAN) tok am for one press statement dem release ova di weekend. Wan person wey be JDWAN too say dem dey saddened say despite our dedication to our work, we dey subjected to indiscriminate extortion, violent harassment by di management. Dem National Leader of di association, Comrade Akintade Abiodun say di multiple levies on di joint drivers by di garage boys and law enforcement agents don cause increase in di prices of food items for Lagos compared wit oda states, as garage boys wey mount road blocks on Lagos road dey put plenty money on consignments wey dey enta di state. WATING DEM DEY ASK FOR  Bus drivers for Lagos say dem no wa

President Buhari yan on top di Terror wahala inside Abuja

Prent
Tori As We Dey WakaCome: Nigerian President Buhari don react on top di terror alart inside Abuja, BuBu yan say make una no fear say di US and UK advice to dia pipo no call for panic. Nigeria President Muhammadu Buhari say di terror alert by di foreign kontris no mean say attack go happun. Nigeria leader reaction dey come as some kontri bin first issue terror alert say threat of terror attack dey for Abuja. Bubu yan for statement wey im tok-tok pesin, Garba Shehu release on Friday say im don charge security operatives to dey alert since afta di attack on Kuje prison. “No be only Nigeria dey di list of terror threats by foreign goment travel advice to to dia citizens. UK and US travel advisories also tok of  terror attacks wey fit happun for many Western European nations. “However, e no mean say attack go happun for Abuja,” di statement tok. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com

Flood water kill pipu for Yenagoa, di Bayelsa State capital inside Nigeria

Prent
Tori As We Dey WakaCome: How di death of 16 year old Temedi  Yerimene wey drown becos of flooding for Igbogene community for Yenagoa, di Bayelsa State capital, Southern Nigeria na one of di major losses pipo dey count for di flood palava Nigeria dey suffer so. Di boy na from Amabulu in Ojobo community of Ekeremor LGA of Bayelsa but di family dey live for Igbogene. Tori be say di flood push di young boy into di deep canal for di area wen im and im friends go swim for di flood water close to di Bayelsa Ecumenical Centre. Mama of di boy, Yerimene Waka Come yan say di incident happen on Monday 10 October 2022 around 11am in di morning wen im go swimming. "I come back from market and dem tell me say im go swim. I bin think say im go swim for di water wey dey flood for our compound until one of im friends tell me say na di flood drag am into di canal." Efforts by di community search party wey go search for di boy no dey