Nigeria Navy waka with NAPTIP Rescue 50 girls from Ashawo Trafficker pipu hand.

Tori As We Dey WakaCome:


Di Nigeria Navy on top water don waka rescue 50 women from ashawo waka, on top dis matter as e dey hot, dem don arrest 3 pipu wey dem dey suspect say na ashawo International waka, dat wan wey oyinbo dey call sex traffickers inside Port Harcourt.


Lt.-Cdr. Richard Iginla, Base Information Officer, Nigerian Navy Ship (NNS) Pathfinder, do did waka to rescued dis victims for PH city on Sunday.


Iginla yan say did waka join body with Nigeria Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) and the Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC).


According to Iginla, inside Dis 50 Ashawo teenage girls follow dey inside wey dem  rescued, early mormor on Saturday.


Dem yan say na with di help of NAPTIP, wey give dem dis information, because dem self don dey do investigation on top di matter, with small pikin of  14 years of age.


Na 50 young girls dis traffickers forced into ashawo work, that wan wey oyinbo dey call prostitution.


As we dey waka, no be lie.

send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com

Follow us on top Instagram @wakacometv

Follow usom top twitter @wakacometv

Follow us on top Facebook @wakacometv

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria