Posts

Showing posts from August, 2026

P-Square wahala wey scatter dem:P-Square break up

Image
Tori As We Dey Waka Come: P-Square wahala wey scatter dem: P-Square break up because of management palava, money matter, and who dey control di music and business. Na di twin brothers Peter and Paul Okoye, plus dia big brother Jude Okoye, di wahala start from. Peter feel say dem no dey rate am, and dem dey sideline am for creative decisions. Fan dey compare dem publicly, and dat one add more tension. Business disagreement too enter, and all of dat na wetin lead to di permanent quarrel wey scatter di group. As We Dey Waka, No Be Lie. For Advert email us E:mail wakacometv@gmail.com

Fifa president Gianni Infantino dey plenty pressure for di past few weeks wit some unpopular decisions im take for di football body.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Fifa president Gianni Infantino dey plenty pressure for di past few weeks wit some unpopular decisions im take for di football body. Fifa bin propose controversial lan to sell minority stakes for di World Cup to private investors, but dem face ogbonge backlash, wey force Infantino to cancel dat proposal. European associations and Uefa bin strongly reject dis proposal wey dem tok say di World Cup gatz dey protected – no be business wey dem go sell to make profit. Infantino bin offer all do associations $40m if dem support di proposal for private investment into di tournaments, through new subsidiary, FFE. Inside Fifa itserf, im get support from some of di council members for dis proposal even though pipo like Luis Figo bin ask am to resign. "Infantino don scata di office im promise to elevate, now ibi too late to save im dignity, but e no dey too late to save football." Gianni Infantino don apologise for di "error" ova di ...

Ghana, di New Patriotic Party (NPP) dey protest wetin dem describe as 'Democracy Under Attack'.

Image
Tori As We Dey Waka Come: opposition party for Ghana, di New Patriotic Party (NPP) dey protest wetin dem describe as 'Democracy Under Attack'. Dem say among oda tins, di National Democratic Congress (NDC) govment dey oppress dem, wey dem dey clampdown on free speech. Party leaders don gada dia followers to hit di streets on di day di kontri dey mark one year since di deadly helicopter crash wey kill eight pipo including govment ministers. According to di opposition NPP, many tins for di kontri no dey go on well, na so dem dey demand say tins go change. Leading party members, members of parliament (MPs) wey belong to di opposition party and oda sympathisers dey part of dis protest. According to di opposition party, di recent acquittal and discharge of ex-Microfinance and small loans Centre (Masloc) CEO, Sedina Tamakloe-Attionu afta dem extradite her from di US to serve her 10-year jail term, no dey fair. Di Court of Appeal set her free sake of dem ...

JAGABAN don waka yan EFCC Make Dem Unfreeze Osun Govt Account

Image
Tori As We Dey Waka Come: JAGABAN don waka yan EFCC Make Dem Unfreeze Osun Govt Account President Bola Tinubu don tell EFCC make dem go court quick quick go vacate di order wey dem use freeze Osun State Government account. Dis matter don cause wahala. Opposition parties dey question am, lawyers and civil society groups dey support am, Osun Govt don drag EFCC go court, and plenty Nigerians for social media dey ask make di EFCC Chairman, Ola Olukoyede resign or dem remove am. As E Dey Hot On Wednesday, EFCC talk say nobody should withdraw money from Osun State Government statutory allocation account because of ongoing investigation. According to di anti-graft agency, na because of suspicious movement of money dem do am. Dem dey investigate how about N11 billion from Ecology Funds, Intervention Funds, and FAAC allocation dey disappear. Preaidom don waka yan talk on Thursday, President Tinubu sign statement himself and order EFCC make dem go court immediate...

Fresh details don emerge about di release of 308 pipo wey Nigerian authorities say dem rescue from kidnappers den.

Image
Tori As We Dey Waka Come:  25 pipo kpai, dem bury dem for captivity. Snake bite 3 pipo.   Fresh details don emerge about di release of 308 pipo wey Nigerian authorities say dem rescue from kidnappers den. Dis latest release na wetin dem describe as di kontri "largest single-day operation" wey involve joint security forces. Among dose wey dem release na 163 pipo from Nigeria north-western Kwara State, wey kidnappers abduct during February attack on two communities for Kaiama district, Woro and Nuku. "Dem go through veri difficult ordeal. One woman say three pipo dey bitten by snakes. She also say about 25 pipo die for dia and dem bury dem at di location," e tok. Di released group include women, children and elderly pipo, many of dem dey for poor health. Danbaba say afta di victims arrive for Ilorin, di state capital, "about 40 pipo dey rushed to di hospital for medical attention". Dem take di victims first to military facility for neighbouring N...

Ezekiel Nathaniel Carry Commonwealth Games Gold for 400m Hurdles

Image
Tori As We Dey Waka Come: Ezekiel Nathaniel Carry Commonwealth Games Gold for 400m Hurdles Ezekiel Nathaniel Carry Commonwealth Games Gold for 400m Hurdles Nigeria boy Ezekiel Nathaniel run well and carry gold for men 400m hurdles for Commonwealth Games! E finish di race with time 48.47 seconds 🏃‍♂️💨🥇 As We Dey Waka, No Be Lie. For Advert email us E:mail wakacometv@gmail.com

Ten-Woman Super Falcons Beat Zambia Make Dem Revive Dia WAFCON Hopes

Image
Tori As We Dey Waka Come: Ten-Woman Super Falcons Beat Zambia Make Dem Revive Dia WAFCON Hopes Nigeria don revive dia TotalEnergies CAF Women’s Africa Cup of Nations title defence with hard-fought 1-0 win over Zambia for Rabat on Saturday night — even though dem play most of di match with 10 women. Asisat Oshoala score di only goal for 8th minute for Al Madina Stadium. Di win come after Super Falcons shock everybody with opening defeat to Malawi. Di performance tonight na pure discipline, resilience and survival. Nigeria spend more than half of di game dey defend dia lead after Oluwatosin Demehin collect red card for 40th minute. Zambia press well for second half dey find equalizer, but di defending champions hold body and carry 3 important points for Group C. Di result keep Nigeria quarter-final hope alive. Earlier dat day, Malawi beat Egypt 3-1, and dat one put more pressure on di champions. Oshoala Give Nigeria Fast Start Niger...

Portable, don lose im celebrity boxing rematch against Charles Okocha.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Portable Disqualify for Rematch Against Charles Okocha Street-pop singer Habeeb Okikiola , wey everybody know as Portable , don lose im celebrity boxing rematch against Charles Okocha . Dem disqualify Portable after e walk out of di ring before di first round even finish. Di fight turn to wrestling-style wahala before officials come separate dem. For di middle of di chaos, Portable just waka comot from di ring. Dem try beg am make e come back, but e refuse. Because of that, dem disqualify am and give Okocha di victory for di highly anticipated rematch. As We Dey Waka, No Be Lie. For Advert email us E:mail wakacometv@gmail.com