Tony Elumelu: Na Oyinbo way of greetings be that, Good Morning, Tony.

TORI AS WE DEY WAKA COME:
Good Morning, Tony
Na Oyinbo way of greetings be that. 
Chairman of United Bank for Africa, UBA, Tony Elumelu, don teach one graduate trainee lesson because she call am by him first name during di induction of 5,000 new staff wey di bank just employ.

Di tin happen for di induction program. One of di new workers collect mic to talk, and she just call Elumelu Tony straight.

Elumelu look surprised. He tell her make she correct herself.  
But when dem give her chance again, she still call am Tony. 
For di video wey don go viral for social media, Elumelu explain say make people address am with respect. He say he no dey support dat Oyinbo culture of calling big people by first name.

Since den, people don dey yarn about am online.  
Some dey talk about workplace manners, generation gap, and how we suppose dey address big oga for Nigeria company.

As We Dey Waka, No Be Lie.
For Advert email us
E:mail wakacometv@gmail.com

Comments

Popular posts from this blog

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.