Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.

Tori As We Dey Waka Come:

After Di announcement about Di election wey dem do for Uganda, pop star Bobi wine, waka yan press pipo about di magomago and wuruwuru wey happen on top this election.

Him yan say, na lie lie result and him no go accept am, say Yoweri Museveni no be him presido.
Just after him yan dis matter for him house, na him soja plenty stand in front of him house, dem no allow any body to enter again to go see Bobi Wine, and him no fit come outside to see anybody, dis one na house arrest dem give am, soja jump enter Bobi Wine house, when him wife dey try plug fruit wey dem go chop, as food don finish inside house for dem to chop, di soja no allow bobi wine wife to plug di fruit, now Bobi Wine dey cry out to pipo to helep chook mouth inside Dis matter, as food don finish inside house, and dem no allow dem to come outside.

76 years old Yoweri Tibuhaburwa Kaguta Museveni, wey don be President for Uganda since 1986, don waka put him self again as the presido of Uganda, na him make am put soja infront of Bobi Wine house.


www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.