Posts

Showing posts from June 15, 2025

herdsmen attack for Benue state

Image
  Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: Play video herdsmen attack for Benue state  attack don lead to di death of many villagers for Benue State, North central Nigeria. Di attack happun for Yelwata, a Benue border town wit Nasarawa state wia suspected armed herdsmen attack di pipo on Friday night. Authorities don confam di incident. Benue state govnor Hyacinth Alia condemn di attacks and killing of innocent citizens for Yelewata, say ''nobody get right to take anoda pesin life'' Officials say at least 45 pipo die during di overnight attack for central Nigeria. But local sources say di number high pass this one. Eyewitnesses say na armed cattle herdsmen carry out di attack and police say dem engage di attackers for gun battle. Dem burn down many houses for di raid on Yelewata town. "Di police and tactical teams wey dey di town and reinforcement respond sharpaly to di attack and engage di attackers for serious shoot out and some of di attackers di in di process", B...

Dem assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal

Image
  Play video Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: Dem assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal Una welcome to dis ogbonge Waka, wey we carry waka come, my name na KAYDI. Olopa yan say Albert Ojwang "sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall". Im death don spark widespread outrage for Kenya, as rights groups dey demand say make authorities hold police accountable. Dem detain 31-year-old Ojwang afta one complaint by di deputy police chief, wey dem accuse say e tarnish im name on social media. "Di cause of death dey very clear; head injury, neck compression and oda injuries spread all ova di body and dat dey point towards assault," state pathologist Bernard Midia tok. AS HE DEY HOT: Olopa arrest Oga Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, sake of one post e make on X wey allegedly dey critical of Deputy Inspector General of Police Eliud Lagat. Dem later transfer am go di capital, Nairobi, wey dey ova 350km (220 miles) from ...

India plane wey dey head to London crash wit over 200 pipo onboard

Image
  Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: India plane wey dey head to London crash wit over 200 pipo onboard Play video Una welcome to dis ogbonge Waka, wey we carry waka come, my name na KAYDI. Di plane wey dey head to London crash small time afta e take-off for Ahmedabad, western India.  One senior police officer for Ahmedabad tell ANI news agency say di London-bound plane crash inside one doctors hostel, wey be accommodation for local medical professionals. E say police, firefighters and oda civic workers reach di spot within minutes. Rescue operations still dey go on. Ambulances dey all over di area. Roads dey blocked. Emergency response teams dey try to quench di fire. Officials don confam say na 242 passengers and 12 crew members na im dey onboard di Air India plane wey crash. Faiz Ahmed Kidwai, chief of India directorate of civil aviation, tell di Associated Press say di plane crash inside one residential area called Meghani Nagar.