Dem assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal
Dis Na Tori, As We Dey Waka Come:
Dem assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal
Una welcome to dis ogbonge Waka, wey we carry waka come, my name na KAYDI.
Olopa yan say Albert Ojwang "sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall".
Im death don spark widespread outrage for Kenya, as rights groups dey demand say make authorities hold police accountable.
Dem detain 31-year-old Ojwang afta one complaint by di deputy police chief, wey dem accuse say e tarnish im name on social media.
"Di cause of death dey very clear; head injury, neck compression and oda injuries spread all ova di body and dat dey point towards assault," state pathologist Bernard Midia tok.
AS HE DEY HOT:
Olopa arrest Oga Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, sake of one post e make on X wey allegedly dey critical of Deputy Inspector General of Police Eliud Lagat.
Dem later transfer am go di capital, Nairobi, wey dey ova 350km (220 miles) from wia dem arrest am and book am for di Central Police Station on Saturday.
Olopa tok say dem later find am unconscious for im cell wit injuries e do on himself (self-inflicted injuries).
But one autopsy, wey five pathologists carry out and dem release unanimous report, reveal say Ojwang get severe head injuries and e suffer neck compression and multiple soft tissue trauma.
Dr Midia, wey lead di team of pathologists, tok say Mr Ojwang no hit himself on di wall, as Olopa bin tok for statement on Sunday.
E say if Ojwang bin wunjure imsef, di pattern of injuries for dey different, and dem go see frontal bleeding on im head.
"But di bleeds wey we see on di scalp… for di skin of di head no dey togeda, including on di face, sides of di head and for di back of di head," Dr Midia tok for one press conference.
Comments
Post a Comment