herdsmen attack for Benue state
Dis Na Tori, As We Dey Waka Come:
herdsmen attack for Benue state
attack don lead to di death of many villagers for Benue State, North central Nigeria.
Di attack happun for Yelwata, a Benue border town wit Nasarawa state wia suspected armed herdsmen attack di pipo on Friday night. Authorities don confam di incident.
Benue state govnor Hyacinth Alia condemn di attacks and killing of innocent citizens for Yelewata, say ''nobody get right to take anoda pesin life''
Officials say at least 45 pipo die during di overnight attack for central Nigeria. But local sources say di number high pass this one.
Eyewitnesses say na armed cattle herdsmen carry out di attack and police say dem engage di attackers for gun battle.
Dem burn down many houses for di raid on Yelewata town.
"Di police and tactical teams wey dey di town and reinforcement respond sharpaly to di attack and engage di attackers for serious shoot out and some of di attackers di in di process", Benue police tok-tok pesin, DSP Edet Udeme tok for statement.
E add say "na wit great sadness we report say some pipo lost dia lives and oda wunjure".
On Sunday youths enta street to protest di killings wey no be like say e go stop.
Comments
Post a Comment