Posts

Showing posts from November 5, 2022

Asuu Strike - Lecture dey para on top half salary for wey Gov pay dem.

Image
Tori As We Dey WakaCome: Lecturers dey live life of struggle', Asuu tok afta goment pay 'half salary' Tori waka come out on Thursday say federal goment pay lecturers half salary for di month of October. Goment neva give reason for di payment wey dem make to di lecturers wey suspend dia almost nine month old strike for di same month. NaFriday 14 October dem suspend di strike and resume on Monday 17 October - "federal goment don reduce academic workers to daily paid workers," na so one lecturer tok. Dr Austen Sado, di National Investment Secretary of di Academic Staff Union of Universities (Asuu) for interview yan say dem dey disappointed in goment. Oga Sado wey be member of di National executive council of Asuu say part of wetin lecturers dey complain of na poor salary wey goment dey pay dem compared to how politicians dey collect plenty money. E say e no make sense say on top of di poor salary dem dey collect, goment still get m...

Nigeria President yan onto food matter

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Waka enter farm! If you dey hungry, No bi small matter Ontop food waka wey make we Nigeria President Muhammadu Buhari yan dis matter. He still talk say, he dey aware say flood don scatter scatter some farmlands this season but say we still dey sell rice made in Nigeria, and e fit to feed all of us. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.