Asuu Strike - Lecture dey para on top half salary for wey Gov pay dem.
Tori As We Dey WakaCome:
Lecturers dey live life of struggle', Asuu tok afta goment pay 'half salary'
Tori waka come out on Thursday say federal goment pay lecturers half salary for di month of October.
Goment neva give reason for di payment wey dem make to di lecturers wey suspend dia almost nine month old strike for di same month.
NaFriday 14 October dem suspend di strike and resume on Monday 17 October - "federal goment don reduce academic workers to daily paid workers," na so one lecturer tok.
Dr Austen Sado, di National Investment Secretary of di Academic Staff Union of Universities (Asuu) for interview yan say dem dey disappointed in goment.
Oga Sado wey be member of di National executive council of Asuu say part of wetin lecturers dey complain of na poor salary wey goment dey pay dem compared to how politicians dey collect plenty money.
E say e no make sense say on top of di poor salary dem dey collect, goment still get mind pay dem half salary.
Di Asuu oga say "wetin lecturers dey get as salary no dey enough.
"We see dis as an attack on education and development of dis nation."
Dr Sado say im neva dey sure of wetin fit happun but wetin dem don observe be say wan reduce di power of unions for di kontris especially di strong ones like Asuu.
E say na only di pipu fit stop goment from dia plan becos "wetin dem dey do dey affect di pipu too."
E add say wetin di lecturers of public schools dey agitate for na national challenge wey dey affect evri body.
"Sake of di freedom in academics most of our members dey tok dia mind on issues wey dey affect dis kontri.
"Dem wan run goment wey nobody fit challenge dem, dis na why dem wan muscle unionism for Nigeria."
Dis na di tori wey we carry waka come.
As we dey waka, no be lie.
Remember to follow us on top we social media page.
Facebook @wakacometv
Instagram @wakacometv
Follow us on top
twitter @wakacometv
You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv
If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or
send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com
As we dey waka, no be lie.
Comments
Post a Comment