Posts

Showing posts from January 21, 2021

Ondo State give herdsmen 7days to waka comot for di state.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Inside Akure yesterday, plenty pipo waka come outside to support di matter wey governor talk. Governor of Ondo state, yesterday talk sey E give headsmen 7days, make dem waka comot from Ondo State, and forests. Governor Oluwarotimi Akeredolu don order Say make all dis herdsmen dem comot from bush inside forest for Ondo State, dem say dem no wan see dem at all, him don give dem 7days make dem waka. Di pipo of Ondo State, happy with dis good decision wey Governor yan, Di Chairman of the National Union of Road Transport Workers, Comrade Jacob Adejo sef talk about how dis herdsmen dey kill pipo, him say road no dey safe again because of dis herdsmen dem. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

US President 1st day inside office cancel Nigeria and some kontri from Ban

Image
Tori As We Dey Waka Come: On Wednesday wey be 20th of January 2021 Donald J. Trump colourr for White House. Joe Biden don waka enter White House, As di new President of di United States of America. Today wey bi 21th of January him yan on top paper, one of di waka wey him go like change, as di new president. Today wey go bi him first day inside office, Joe Biden don cancel all di ban wey former US President give, as di matter dey sup now, all di kontri wey Trump no allow to enter US go fit enter now. Di name of di kontri wey go fit travel go US now with out wahala na, Nigeria, Eritrea, Yemen, Sudan and some kontri. Dis wan go dey for history say black woman enter power as vice president of di United States of America yesterday, when dem put dem for office. Di new president wey enter office on Wednesday, yesterday wey bi 20th of January 2021, as di President of di United States of America, him name na, Joe Biden and him vice president na black woman, her name na Kamala Harris, Dis...

Vice Principal Rape, 12 years old girl in kastina.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Vice principal arrested for impregnating 12-year-old student in Katsina. Police don arrest One Vice Principal of one secondary school for impregnating one of the students for the school. Dis matter happen for Rimi Local Government Area of Katsina State, the teacher name na Ibrahim Tukur. E get one secondary school for Rimi Local Government Area inside Katsina State, na him one Vice principal Ibrahim Tukur, give small pikin wey be student of di school, belle. Police don arrest this Ibrahim. Presently, the girl wey him give belle na 12 years old pikin, and dis 12 years old girl don born di pikin. Ibrahim Tukur and him padi wey dey do dis bad thing, police don catch all of dem on Wednesday, dem dey inside Kastina Police Command headquarter www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Woman Die With Her Baby For Road Yesterday

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis wan happen yesterday 20th of January, Inside warri Delta State, as police dey waka with motor to catch yahoo boys, dem kon go jam one keke wey carry passenger of one woman and her small pikin, for road on top high way, dis woman and her pikin kpai instantly. Dis wey dey painful so, happen for PTI junction inside Effurun. Di police wey jam dis woman and her pikin, na from Ebrumede police station dem come from. Di pipo wey use eye see the matter no happy at all as di woman and her pikin die,  dem burn police motor wey jam dis woman inside keke, dem even block road. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome