US President 1st day inside office cancel Nigeria and some kontri from Ban

Tori As We Dey Waka Come:

On Wednesday wey be 20th of January 2021 Donald J. Trump colourr for White House. Joe Biden don waka enter White House, As di new President of di United States of America.

Today wey bi 21th of January him yan on top paper, one of di waka wey him go like change, as di new president. Today wey go bi him first day inside office, Joe Biden don cancel all di ban wey former US President give, as di matter dey sup now, all di kontri wey Trump no allow to enter US go fit enter now. Di name of di kontri wey go fit travel go US now with out wahala na, Nigeria, Eritrea, Yemen, Sudan and some kontri.

Dis wan go dey for history say black woman enter power as vice president of di United States of America yesterday, when dem put dem for office.

Di new president wey enter office on Wednesday, yesterday wey bi 20th of January 2021, as di President of di United States of America, him name na, Joe Biden and him vice president na black woman, her name na Kamala Harris, Dis vice president na black woman from South Asian, dis go be di 46th president of America.



www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.