Plasings

Wys tans plasings vanaf Februarie, 2021

Sunday Igboho: DSS Waka Fail as Dem Try to Carry am.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Security Agency, wey dem dey call DSS and  soldier try to arrest Yoruba activist Sunday Adeyemo Igboho, for road along Lagos-Ibadan expressway on Friday, february 26th 2021, him followers no allow dem to carry am as dem ready to protect dia leader. Di matter bi say Sunday Igboho bin go meet Yoruba socio-political group, Afenifere chief, Ayo Adebanjo wen di matter happen, as im dey go for road na him DSS and some Army block am for road. Sunday Igboho Media person yan say di matter happen around 2pm wen dem bin dey on dia way out of Afenifere house, two heavily armed military operatives stop dem come ask if Sunday dey inside di motor, na so wahala start, Sunday boys no allow dem to carry am. Inside did video una go see as Sunday follow dey parra, dem no allow DSS to carry any action. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Zamfara kidnapping: Gunmen Abduct 300 plus Jangebe Government Secondary School Girls.

Prent
Tori As We Dey Waka Come:  Di Zamfara state police command don confirm di abduction of 300 plus students wey gunmen kidnap from dia boarding secondary school early today for di town of Jangebe, for Zamfara state. Father of one of di kidnapped Jangebe students say: E dey pain me say I no follow go visit my pikin di last time. Father of one of di kidnapped students for Government Girls Secondary School Jangebe don share im pain and how E feel wen news of him daughters kidnap reach im ear. Mohammed Rilwanu talk say two of im daughters dey among di 300 plus students wey gunmen kidnap from Government Girls Secondary School Jangebe on Friday the 26th. E talk say since di news of di daughters kidnap reach am, for hours now wetin dey im mind na how e no follow go visit dem last month during di school visiting day. Him bin receive phone call about wetin happen for di school around 1:45am till 3am and by di time im reach there some parents don dey there but by den

Promo! Promo!! Promo!!!

Prent
Awoof Awoof Awoof!!!! E no de purge belle... Dis na ogbonge awoof promo for everybody way dey into music, waka come Tv don waka come with better awoof wey go hellep you wey be musician to get ogbonge musical video with 4K camera and better jolification waka on top dis matter now, with just 600,000 six hundred thousand naira, you go shoot standard MTV/SoundCity/TraceTv, musical video quality plus 1month promo on top one of dis Tv station, e never finish o!!! Plenty ogbonge media promo follow waka ontop dis matter. Di number to call na 08133385379                             .............................English..........................   Shoot a music video with 600K six hundred thousand naira, and get 1 month free promotion on any of this musical Tv station like MTV/SoundCity/TraceTv and more. guess the amazing thing, you are shooting on 4k, not 2k, 2.5k but 4k... 4k high definition with professional quality colour grading... MTV/SoundCit

Orlu crisis: Nigerian Army send helicopter go Orlu.

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Military dey do air strike for Orlu as we dey see inside dis video Nigeria Military helicopter go Orlu town, for Imo State, southeast of Nigeria. Three weeks ago, jaguda pipo do shooting for di area kill pipo and burn some houses. E dey on top all social media for Nigeria on top dis matter wey dey hot for Orlu, some local tori pipo dey report say Nigeria Military dey conduct air strikes for Orlu as dem dey try catch members of Eastern Security Network (ESN). Different video of this matter dey sup on top twitter, Instagram and Facebook.   Helicopter fly pass dem as e fly out of di view of di video you fit hear gun shot. One man voice dey shout, "ha! Jesus Christ o! wia dis one dey? Ha! Why dis pipo dey waka upandan abeg? Why dis pipo dey… Jesus see gun. Ha!... make everybody enta... See di video: wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakaco

Breaking News: Mysterious Death of National Open University Nigeria (NOUN) Student.

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Mr Adisa Kehinde Ashimolowo talk say im be Fatimah Papa, Mr Adisa Kehinde  Ashimolowo dey stay for Ibadan, with Fatimah wey be him first daughter. Im say dem call am on top phone say im daughter fatimah waka go write exam on di 17th of February in the morning and later dem call am di next day on di 18th say dem see her dead body for road Gbagada under bridge, Lagos. Him talk say di person wey see him daughter body, wey be di eye witness yan say dem no see im daughter phone with am. Mr Adisa Kehinde Ashimolowo confirmed say dem bury her for Lagos inside Atan Cemetery that same day because im na Muslim man.  Di CONS National president talk to Mr Adisa Kehinde Ashimolowo say all di students grievance for di sad news of fatimah's wey die and dem go protest. Mr Adisa Kehinde Ashimolowo talk say di students fit waka come to visit their house for *Alfa Ojuotono House, by Kulodi Market, Amuloko area, Iwo Road Ibadan, Oyo state*

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Dis na di pipo wey waka go house with Headies for di 14th edition Headies Award 2021, wey happen did February, di award waka come with ogboge celebrity like Wizkid, wey dem dey call star boy Machanla, E waka with Award as Artiste of The Year, Omah Lay win Next Rated, Mayoukun, Fireboy and plenty odas waka with Awards too.  Fireboy win four awards for di 14th edition of di Headies, wey be music award show for we kontri Nigeria. Him win Best R&B Single, Best R&B Album, Best Pop Award and Best Headies Revelation to make am di artiste wey pack di most awards waka go house. Starboy Wizkid win Artiste of di year and Viewers Choice Award. Di award show bin hold online to keep with di Covid 19 restriction for Lagos, but plenti pipo still gada around di streaming platforms to see di show as e dey hot. We very own King Sunny Ade collect award as him join di Headies Hall of Fame. Niniola and S

Kaduna state: Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church.

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church, and two homes, inside Kikwari village, Kajuru local government area for Kaduna state. Samuel Aruwan, Commissioner, Ministry of Internal Security and Home Affairs, Kaduna State, talk on Sunday, say pipo run com or for di area when di gbege start, as dem receive information say bandits dey outside di village. Di armed bandits burn di church and two houses. Di Governor El-Rufai feel very bad, him talk say him go use him office to give protection and hellep to provide for di pipo and continue to work hard to fight against banditry and other crimes. Him tell worshippers to remain strong in their faith and devotion, and to see dis as an act perpetrated by enemies of peace, humanity and diversity wey no go succeed but will be defeated by the grace of God. Di Governor don direct di Kaduna State Emergency Management Agency to urgently assess the damage done and

BELLO AMBASSADORS NETWORK, (BAN)

Prent
BELLO AMBASSADORS NETWORK, (BAN) www.ban2023.org E sweet us for belle as we don waka come with ogbonge network for the Nigerian youths for we kontri Nigeria, from six (6) geopolitical zones and thirty-six (36) states for we federation. Dis na non-governmental Organisation with common agenda to fit copi di leadership and charitable character of Governor Yahaya Bello of Kogi State. Dem dey support to helep we pipu wey need urgent help to support dem as Governor, and Yahaya Bello dey promote quality leadership. As the youngest Governor for Nigeria, Yahaya Bello don do better waka and him build cabinet of young Nigerians sote e no even look tribe, gender and religion. The ogbonge waka of Governor Yahaya Bello for areas of Education, Healthcare, Agriculture, Security and Infrastructure reach something wey we suppose dey give national recognition for. We don see courage, intelligence and love of every Nigerian for inside Governor Yahaya Bello with the wey him be dey c

Breaking News: Military aircraft don crashes inside Abuja.

Prent
Tori As We Dey WakaCome:  Di matter happen today wey be Sunday 21st of February 2021, Nigeria Military aircraft crashes for Abuja. Hadi Sirika wey be di Aviation Minister, confirms di crash of military aircraft King Air 350 close to Nnamdi Azikiwe International Airport Abuja. E talk say di aircraft crashed “short of our Abuja runway after reporting engine failure enroute Minna” Sirika say di air crash “bin dey fatal” but make we kontri pipo dey calm down for we military to investigate di matter. see di video: wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

School Girl Wey Carry Gun Enter School To Kill Teacher, Don Confess

Prent
Tori As We Dey WakaCome: The secondary school girl for Ikot Ewa community, for Cross River State don come out to confess say, she na cultist for one girls confraternity, for CRS, wey dem call themselves "Sky Queen Confraternity." The girl wey dem identify as Promise Idorenyin, na 17 years old, dem   arrest her last week for one Community Secondary School for Ikot Ewa inside Akpabuyo local government area of Cross River State, after she bin try to shot one of her subject teacher with one local made pistol, wey she bin later confess say na one of her married man friend wey dey totori her body, give her. Dem still dey interrogate the girl for further inquiry of the supposed confraternity wey she mention during her confession, to know which other students and teachers wey dey at risk for that same school wey she dey attend. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakac

Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Government Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher wey tell her to barb her hair. Dis Government Secondary School girl carry one local made gun enter School for Akpabuyo, Ikot Ewa Cross River State to shoot her teacher because im tell her to cut hair hair. Dis matter happen for Community Secondary School Ikot Ewa for Akpabuyo, Cross River State, last week Thursday. E happen say, as di young girl resume school, her class teacher tell am say make she go barb her hair wey she carry come school. Dis na becos, so school for Cross River, students no dey carry grown hair come school as dem get dat kind rule, she gast go back house. Di next day she waka come school wit local gun. Di School Principal raise alarm. Pipo around come hold her and teachers, students all come out to see wetin dey sup for school. One person wey see as di matter happen yan say  im go visit im friend wey dey stay close to school wen dem hear

Commander Hisbah Arrested: Dem Don Catch Islamic Police Oga for Hotel with Woman.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di officer wey dey in charge of arresting prostitutes and beggars for Kano, Hisbah Sani Uba Rimo dey inside serious gbege after police arrest am on Monday for hotel. Police dem bin get report from one man say di Hisbah OC dey invite im wife to one hotel for Sabon Gari area of Kano city were him and di woman dey meet. Just After di arrest, Hisbah suspend officer Sani from work pending investigations dis na after di oga kpata kpata commander general Sheik Harun Ibn Sina form five man committee to investigate wetin happen. Kano Police Command confam say di husband of di woman don come forward to gree say di Hisbah OC na actually im in-law and dey try settle issues between dem. According to tok tok pesin DSP Abdullahi Haruna di whole thing don dey resolved and di Hisbah oga no get case to answer. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie.

Abuja Biggest Entertainer, CEO of ND Motors, A.K.A ABig Nwamama, with him Album launch

Prent
Tori As We Dey WakaCome: We dey waka come with Abuja biggest entertainer,  CEO of ND Motors, A.K.A ABig Nwamama, with him Album launch this Saturday. 20th of February 2021. Picture of Album Banner. Interview by DirectorKD: DirectorKD: Na who be Abig Nwamama? Nwamama: I be Power Bike engineer, I dey sell power bike and I dey do my music, I love music and my best sport na Bike race, I be cool and loving person, I love to entertain people with my bike and music. DirectorKD: we go like ask you about this your album, na wetin carry you waka to make this songs? Nwamama: I get plenty songs wey I don record, plus musical video wey I don shoot, so I say make I drop my album this Saturday wey go be 20th of February 2021, Inside this album we go see say I also want to help pray for Coronavirus make E waka go, I get song wey I also shoot the video with plenty power bike, Oyele and so many song wey I record as e dey hot. DirectorKD: tell us about your album, na wey dey come and how di w

Government Science College, Kagara, kidnap update: Buhari deploy soldiers, Governor close down school, Senate demand State of emergency.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Di President of Nigeria, Muhammadu Buhari order di military and police for immediate and safe return of di staff and students armed bandits kidnap from Government Science College, Kagara, for Rafi Local Government Area of Niger state. Benjamin M. Idoma na di name of di student wey di bandits kill. 650 students na im dey di school. Dem kill Benjamin in di presence of other students and staff, as e dey try escape from di school. Niger State Governor, Alhaji Abubakar Sani Bello wey announce di closure dis morning insist say goverment no go pay any ransom to secure di release of anybody wey dem kidnap, say instead dem go use di money take buy ammunitions. Niger State government go review di villages for di state by bringing pipo wey dey live for small communities come big towns wey dey near dem so dem fit provide security for dem until security for di area dey restored. For inside statement by di Senior S

Oyo state Ibadan: Yoruba vs Hausa clash inside Shasha.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: For statement wey di chief press secretary to Governor Seyi Makinde, Mr. Taiwo Adisa, drop, im say dem set di curfew make law and order no dabaru for di area as dem also set for Shasha and di market area. Di curfew time go be from 6pm to 7am. Dis na videos of some place for Shasha. Di popular Shasha Market, for Ibadan, Oyo state South West Nigeria after youths from both di Hausa and Yoruba communities fight. According to local tori pipo, na misunderstanding start di mata and na so di two tribes start fight. Inside Shasha 50 shops and plenti goods and property don spoil finish, before security waka come. Dem even tiff from some shops & houses. Oyo state governor Seyi Makinde don order curfew for di area Di Oyo State government don order di sharpaly closing of Shasha market for Akinyele Local Goment Area of Ibadan. Inside di statement, dem drag ear give warning to residents for di area say make dem run dia legal and legit business peacefully, as dem add say

Di full videos and Tori about Today waka for Lekki Toll Gate protect.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Dem don arrest Popular Nigerian comedian, Debo Macaroni and oda Nigerians wey bin dey "pass" Lekki tollgate, venue of planned protest by protesters. Mr macaroni go live on him phone inside van. Debo Macaroni a.k.a Mr macaroni as dem put am inside van. Dem don collect all di pipo phone inside van.  Him yan say, based on democracy and freedom of waka go any where go talk, as im be Nigerian wit rights to go anywhere im feel like," police still throw am inside dia van alongside oda pipo wey dem bin don arrest. Di comedian bin go live for Instagram to tell "di world how police dey abuse human rights for Nigeria." During di live, Macaroni tok about how im bin dey go about im normal business before e come decide to go di protest venue to "see tins for himself. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Gunshots inside Obalende: Today di rival groups of NURTW clash inside Lagos.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: picture on top of obalende bridge, as pipo dey run. Di Tori be say, Plenty pipo dey run, when dis wahala happen for around Ken Salem House. Wahala for who no sabi run, as agbero plenty wey dey parra, early mo mo around 8am today, wey be Thursday 11th of February 2021. Na so pipo dey run, as dem see agbero wey plenty with gun, as dem dey shot dey scatter every thing, no be small wahala happen today inside obalende, dis fight na between di rival groups of the NURTW, wey dem dey call, National Union of Road Transport Workers. Inside dis matter, plenty shop don skater and some pipo get injury as dem dey try run for safety. Dis na di video... https://youtu.be/KZ2LEhjw9W4 Gunshots clash in obalende wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Nickelodeon Kids Choice Awards (KCA): Don nominate Emmanuella and Ikorodu Bois.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Emmanuella and Ikorodu Bois Di International awards wey dem dey call di Nickelodeon Kids Choice Awards (KCA) don drop dia 2021 nominees list wey dem add we Nigerian talented pikin put inside,dis one make plenty African pipo happy well well, as Dis year nomination get pipo like Ikorodu Bois, Emmanuella, Elsa Majimbo, Bonang Matheba, Mo Salah, Master KG plus GhettoKids and more. Di competition dey tough for di Favourite African Social Media Star award wey some veterans and some fresh face wey ginger pipo all ova di world. Celebrity Actor, comedian, Saturday Night Live legend — with Kids' Choice Award winner! — Kenan Thompson, go host di show wey go waka come on March 15 wey go be Monday 2021. All fans fit waka home to votes on top Twitter and also online for www.kidschoiceawards.com, and for Screens Up app wey dey work for iPad, iPhone, and Android devices for inside U.S.A Di African celebrities plus fans go dey