Sunday Igboho: DSS Waka Fail as Dem Try to Carry am.

Tori As We Dey Waka Come:

Security Agency, wey dem dey call DSS and  soldier try to arrest Yoruba activist Sunday Adeyemo Igboho, for road along Lagos-Ibadan expressway on Friday, february 26th 2021, him followers no allow dem to carry am as dem ready to protect dia leader.

Di matter bi say Sunday Igboho bin go meet Yoruba socio-political group, Afenifere chief, Ayo Adebanjo wen di matter happen, as im dey go for road na him DSS and some Army block am for road.

Sunday Igboho Media person yan say di matter happen around 2pm wen dem bin dey on dia way out of Afenifere house, two heavily armed military operatives stop dem come ask if Sunday dey inside di motor, na so wahala start, Sunday boys no allow dem to carry am.

Inside did video una go see as Sunday follow dey parra, dem no allow DSS to carry any action.



wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria