Plasings

Wys tans plasings vanaf Maart, 2021

Big Brother Naija (BBNaija) 2021 Application Form For Season 6

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Dis na How to Apply For BB9jia Una welcome to we igbonge reality Tv program for we kontri 9ja, dis 2021 Big Brother Naija winner go waka come with 90 million naira, e never finish ooo... For more tori and how to Waka on top dis matter, click on dis link πŸ‘‡πŸΌπŸ‘‡πŸΌπŸ‘‡πŸΌπŸ‘‡πŸΌπŸ‘‡πŸΌ Big Brother Naija Season6 Year 2021 wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #bb9ja #BB9jia #Bb9ja

Fatgbems Filling Station Sell Water to Customers in Disguise as Petrol Price Don Enter N212.

Prent
Tori As We Dey Waka Come:  Di matter happen on Sunday 14th of March for Abeokuta, Southwest Nigeria within di same period wen fuel price hike bin happen for all filling stations across di kontri. Di matter don cast for social media, inside one video wey customer notice say na water dem sell give am, plenty pipo don come back to confirm di matter wey make dem car engine get fault. Dis video wey dey trend for social media show where some customers dey lament and accuse di filling station of cheating - di video also show where some car owners dey check dia vehicles to find how to comot di water from dia engine. Di management of Fatgbems filling station for di statement wey dem bring out tok say wetin make dia nozzle pump water instead of fuel na because of "water overflow into one of di station storage tanks." E talk inside statement say, "Fatgbems go like tok am again say di unfortunate incident dey against as we dey take do business as w

Davido Celebrate with Wizkid and Burnaboy for Di Grammy Award Wey Dem Win.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: David Adeleke a.k.a Davido don waka come on top him twitter page @davido to congratulate him brothers wey win Grammy award, wey shele yesterday 14th of March 2021. Davido wey dey America right now dey enjoy life talk on top him twitter page say him dey happy for burnaboy and wizkid, e yan say dis award na for All Nigerians and we culture. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Burnaboy Don Waka Win Best Global Music Album for 2021 Grammy.

Prent
Tori As We Dey Wak Come: Burnaboy don collect Grammy Award. Nigerian musician Burnaboy don collect Grammy Award Wey shele on sunday 14th March 2021. on top dis waka with   Burnaboy   na star boy Wizkid wey waka with Beyonce, to collect Award. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Wizkid Don Carry Grammy Award

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria artist Wizkid don win Grammy Award for di year 2021. Ibrahim Ayo Balogun a.k.a Starboy Wizkid, don waka with grammy award, on top dis waka na with beyounce and blue ivy, wey him follow waka do di song with, wey dem title brown skin girl. on top dis song wey him waka do with beyonce, blue ivy and him self wizkid for di best music video Award. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

NLC 2021 strike: Nigeria Labour Congress [NLC] 'minimum wage protest' ahead of planned strike for all states in Nigeria.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria Labour Congress protest' dey happun all over Nigeria, dis na ahead of dem planned strike action of dis government workers dem. As we dey waka come with dis planned strike wey dey hot right now for all di States inside we kontri Nigeria. Di umbrella labour union of Nigeria goment workers enta street yesterday wey bi Wednesday 10th of March 202 to protest ontop di matters wey dey affect dia members like minimum wage and oda tins. NLC protest for Abuja Unity Fountain As e dey hot for Abuja with Ayuba Waba National President, him lead di pipu to National Assembly building. Mr Ayuba Waba, wey bi National President of Nigeria Labour Congress say dem no happy wit how Nigeria lawmakers wan comot minimum wage matter on top di list. Di NLC leader say na sake of dis mata dem dey protest to show say dem no dey comfortable with dat arrangement and if goment no listen to dem, more protest and strike action g

BREAKING NEWS: NNPC Gas Station Catch Fire For Akute

Prent
Tori As We Dey Waka Come:  Inside dis picture una go see as pipo plenty dey try help to stop di fire wey happen today Saturday 6th of March 2021 dis morning. Dis fire start to dey burn for inside NNPC Gas Station, wey dey along alagbole, for Ore Meji Bus Stop, Akute Road Lagos State. Click on this, to see di videoπŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡πŸ‘‡ NNPC GAS STATION CATCH FIRE FOR AKUTE VIDEO wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Governor Yahaya Bello Meet With President Muhammadu Buhari & OBJ for National Food Matter

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria Presido MUHAMMADU BUHARI waka come with OBJ and KOGI STATE GOVERNOR YAHAYA BELLO on top dis matter of Food dealers Strike, dis waka happen inside Abuja on Wednesday with Chief of Staff, Prof Ibrahim Gambari during a close door meeting wey go hellep solve dis suspension of Food. Di waka continue on Sunday inside Abuja, Kogi State governor, His Excellency, Yahaya Bello meet with the former president Olusegun Obasanjo Inside dis waka with di Chief Press Secretary to Governor Yahaya Bello, Mohammed Onogwu disclose. Him talk say di waka with former Nigeria president Olusegun Obasanjo dey alright, and E go hellep solve plenty matter. Di Chief Press Secretary to Governor Yahaya Bello, Mohammed Onogwu talk say, Former President Obasanjo don yan as e dey hot, on top security waka to di governor of Kogi State, make dem make effort to provide good security for Kogi state, and better information, to di pipo for security w

(AUFCDN) Don Call Off Dia Nation-Wide Strike for we Kontri.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Amalgamated Union of Foodstuff and Cattle Dealers of Nigeria (AUFCDN) don call off dia nationwide strike for we kontri. Di waka happen On Wednesday after dem yan di matter with di Federal Government wey dey represent by Kogi State Governor, Yahaya Bello. Di presido of AUFCDN, Muhammad Tahir, talk say dem decide to call off di strike after government promise to pay di N4.75billion dem demand as compensation, ensure protection of dia members and stop all forms of multiple taxation on di highways. Governor of Kogi State, Yahaya Bello bin don beg di Union to end di strike, as e promise to follow up and ensure say government meet di union demand. Tahir say: "All di stakeholders and members of AUFCDN in our nationwide strike dey glad say we achieve wetin we bin wan achieve. Since di Governor of kogi state, Yahaya Bello beg us on behalf of di government, we agree to call off di nationwide strike today. "Dem agree to pa

Daniel Wilson Timeless Album: dis na new gbedu, wey just waka come outside, as e dey hot.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: We dey jolificate with we Nigerian Music Icon, for we industry, na Legendary Musician im be, we dey talk about our one and only Daniel Wilson, wey be king of RnB music, im don come out with dis Album wey him call am, TIMELESS. Dis na cool jam for old and young, na im oyinbo man dey call ever green music, di song dey sweet for body. Dis Album na 18 tracks wey dey totori person, as e dey hot. Track: 1. language barrier (feat. Abobi Eddiroll) Track: 2. Abortion (feat.BZB) Track: 3.  Good Old Days Track: 4.  The Virus Is Real Track: 5.  Mr Ragamuffin Track: 6.  Oyato' (feat. Gran-P & Obitunez) Track: 7. My Body Is Getting Weak Track: 8.  Heartbreaker Track: 9. 999 Track: 10. Children Of Africa Track: 11. One Naija Track: 12. The government You Deserve Track: 13. Jonathan Been Try Track: 14. Do Something Track: 15. The Youth Are Taking Over Track: 16. Personal Person (Feat. BZB) Track: 17. Follow me lisa Track: 1

Covid19: See Who Go Collect Di 3.92 Million Doses Qf Di AstraZeneca Vaccine Wey Just Enter Nigeria.

Prent
Tori As We Dey Waka Come: Picture of di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine wey just enter Nigeria. AstraZeneca vaccines don enter we kontri Nigeria, dis go make Nigeria di next West African kontri to collect di COVAX Facility after Cote d'Ivoire and Ghana. Di arrival of di vaccine go enable dem begin vaccinate Nigerians in priority groups, starting with di frontline health workers, na so NPHCDA talk. At all levels, di cold chain facilities wey dem go store di vaccine don dey ready. Mr Osagie Ehanire wey be di Minister of Health for we kontri Nigeria, don receive di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine as e arrive di kontri capital, Abuja yesterday. Dem don dey train all di health workers wey go administer di vaccination, na so di National Primary Health Care Development Agency, yan inside statement wey di World Health Organization and UNICEF join body do. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmai

Covid19: Ghana President Nana Akufo-Addo and Him Vice President, Bawumia Go Receive Di First Dose of Di Covid-19 Vaccine

Prent
Tori As We Dey Waka Come:  Ghana President Nana Akufo-Addo and him vice president, Bawumia go receive di first dose of di Covid-19 vaccine. For im yan, President Akufo-Addo him talk say,  dem go deploy di vaccines go 43 districts wey be di epicentres of di pandemic for Ghana, im yan say through di National Vaccine Deployment Plan, dem don segment Ghana population into four groups, and dis go determine which section of di population go collect vaccination at a particular time. 600,000 doses of di vaccine arrive Ghana on February 24, 2021, Ghana na di first African kontri for di world to receive di AstraZeneca vaccines from di COVAX facility. Ghana number one and number two citizens go take di vaccine together with dia spouse live on TV so as to encourage Ghanaians say di vaccine dey safe to take. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As