NLC 2021 strike: Nigeria Labour Congress [NLC] 'minimum wage protest' ahead of planned strike for all states in Nigeria.

Tori As We Dey Waka Come:


Nigeria Labour Congress protest' dey happun all over Nigeria, dis na ahead of dem planned strike action of dis government workers dem.

As we dey waka come with dis planned strike wey dey hot right now for all di States inside we kontri Nigeria.
Di umbrella labour union of Nigeria goment workers enta street yesterday wey bi Wednesday 10th of March 202 to protest ontop di matters wey dey affect dia members like minimum wage and oda tins.

NLC protest for Abuja Unity Fountain


As e dey hot for Abuja with Ayuba Waba National President, him lead di pipu to National Assembly building.
Mr Ayuba Waba, wey bi National President of Nigeria Labour Congress say dem no happy wit how Nigeria lawmakers wan comot minimum wage matter on top di list.
Di NLC leader say na sake of dis mata dem dey protest to show say dem no dey comfortable with dat arrangement and if goment no listen to dem, more protest and strike action go happun.

NCL protesters for Lagos.
Picture of how Police try to stop Di protest
  for Lagos 'Ikeja under bridge' yesterday.
According to Nigeria law books, to remove something from exclusive list, put am for di concurrent list mean say di resposibility to control dat thing go comot from federal government hand enta state government hand.

Nigeria Labour Congress [NLC] protest inside Port Harcourt Nigeria.

Picture of Nigeria Labour Congress [NLC] members for Oyo State protest go di State House of Assembly for Ibadan.


Picture of di Nigeria Labour Congress [NLC] members waka for Kano

women self follow waka on top di matter yesterday for Kano.

wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.