Wahala don burst, For White House.
Tori As We Dey Waka Come: Wahala don dey happen, for White House inside America, United States President Donald Trump don tell im supporters to come Washington DC to challenge di Congress and Vice President Mike Pence, to abandon di results of di November presidential elections, so dat power go remain for im hand, to fit make more correction of the election way no get better waka for 2020, Donald Trump no like as them rig the election for some state inside America. President and some of him speakers start casala on top the matter. President lawyer, say make dem settle di election wahala through "trial by combat." Congress still dey argue wen Trump supporters bulldoze dia way enta di building, kasala burst, katakata everiwia as lawmakers, workers and tori pipo run to find wia to hide. Na so dem start to dey yan, We no go agree o, We no go agree. After this meeting, na him Trump supporters enter the building, na so the matter start, olopa self dey vex, as casala bust...