Wahala don burst, For White House.

Tori As We Dey Waka Come:
Wahala don dey happen, for White House inside America, United States President Donald Trump don tell im supporters to come Washington DC to challenge di Congress and Vice President Mike Pence, to abandon di results of di November presidential elections, so dat power go remain for im hand, to fit make more correction of the election way no get better waka for 2020, Donald Trump no like as them rig the election for some state inside America.

President and some of him speakers start casala on top the matter.

President lawyer, say make dem settle di election wahala through "trial by combat."


Congress still dey argue wen Trump supporters bulldoze dia way enta di building, kasala burst, katakata everiwia as lawmakers, workers and tori pipo run to find wia to hide.
Na so dem start to dey yan, We no go agree o, We no go agree.


After this meeting, na him Trump supporters enter the building, na so the matter start, olopa self dey vex, as casala bust, dem enter every were to do wuruwuru and katakata,  everybody ja to hide, as dem see crowd way enter.


Before (17:00 GMT) time reach, thousands of pipo don gather for Ellipse, Trump rallies supporters, near the White House, to fit listen to Trump.

He tells dem say: "We're going to walk down Pennsylvania Avenue... and we're going to the Capitol and we're going to try and give… our Republicans, the weak ones... the kind of pride and boldness that they need to take back our country."



Around 03:41 on Thursday, the congress dem confirms say na President-elect Joe Biden go takeover President Trump on 20 January.



send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.