Covid-19 Second Wave: Olympic Agency Dey Fight Japanese Government over Tokyo 2020.

Tori As We Dey Waka Come:

Di Deputy Chief Cabinet Secretary don deny sey dem cancel di Olympic Game, dem say na coronavirus wey dey worry dem, make dem talk like dat, dem say dem dey arrange for di year 2032 Olympic game for Tokyo, by that time coronavirus no go dey, Japanese Government don cancel Olympic Games wey suppose start on Di 23rd Of July.

Anoda Tori wey reach us be say, Di Japanese government talk say, pipo dey kpai ontop Dis coronavirus every day, so dem no go fit allow dis game waka come, dem go stop am till, 2032.

Organisers dey parra dey say di game must happen inside dis coronavirus, dem say di Tokyo Olympic Game go open dis year, make di government try understand.

Osaka Mayor Ichiro Matsui don talk say, make dem look as dis second wave of coronavirus dey kill pipo anyhow, say e go good if dem change di date till 2024, because of dis coronavirus.

 www.wakacometv.blogspot.com


send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome


Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.