Michelin-star chef fit go jail because e use ants take garnish dessert

Tori As We Dey Waka Come:

Ants no dey the 10 insects wey law say make people chop for that country.
Wetin dem approve na grasshopper, locust, two-spotted cricket... all those ones.

On Monday, Di prosecutors yan say make dem nack di restaurant fine of 20 million Korean won — na roughly $13,510 or £10,100. And this restaurant get 2 Michelin stars o.

The owner confess say yes e dey serve ants, but e say na just small thing for the 15-course menu. Dem dey use am garnish sorbet. E even talk say dem dey tell customers: "if you no want ant, pick another topping."

The wahala burst after Ministry of Food and Drug Safety officials see people online review. Customers dey post pictures of food wey dem sprinkle ants on top like seasoning

For advert contact WakacomeTV
Email:wakacometv@gmail.com 

Comments

Popular posts from this blog

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.