Russia don carry out big ballistic missile and drone attack on Ukraine
Tori As We Dey Waka Come:
Russia don carry out big ballistic missile and drone attack on Ukraine
Officials talk say at least 8 people don die and dozens don injure.
For Kharkiv for north-east, 4 people die. One old woman die for Kyiv the capital. For south, 2 people die for Zaporizhzhia and 1 person die for Sumy for north-east.
Ukrainian President Volodymyr Zelensky talk say the attack on Kyiv na "one of the most massive ballistic attacks" since Russia start full-scale invasion for 2022.
For Sunday night, Ukraine navy talk say 5 people die when Russian missiles hit one Turkish civilian cargo ship wey dey carry grain for Black Sea. Russia never talk anything about am.
Meanwhile, Ukraine talk say dem don hit 3 Russian oil tankers for Black Sea, and 3 oil depots for southern Stavropol region. Zelensky talk say na those places dey "finance Russian aggression".
Many areas for Kyiv region collect hit for night. Ukrainian military talk say dem shoot down 18 out of 41 missiles for the capital. Dem also intercept 108 drones.
Dis na di ogbonge waka we carry waka come today as E Dey Hot. As We Dey Waka, No Be Lie.
For advert contact WakacomeTV
Email:wakacometv@gmail.com

Comments
Post a Comment