UK humanitarian worker don fly come London hospital make dem monitor am for Ebola

Tori As We Dey Waka Come:

UK humanitarian worker don fly come London hospital make dem monitor am for Ebola

One humanitarian worker wey dey Democratic Republic of Congo don medically evacuate come UK after e get possible exposure to Ebola for hospital.

UK Health Security Agency (UKHSA) talk say the person na UK resident, but dem no mention name. The person no get any symptoms, and dem bring am come just as precaution.

UKHSA talk say the person still dey alright but dem dey check am and monitor am for one London hospital.

Dem no mention which hospital, but Royal Free for north London get high-level isolation unit. Na dat place be the main center for serious infectious diseases.

Ebola incubation fit take from 2 to 21 days, so the humanitarian worker go need to isolate all through dat time.

The person bin dey work with humanitarian organization wey dey help fight Ebola outbreak.

About Ebola:
Ebola na very dangerous sickness. Unlike flu or Covid, e no dey fly for air. E dey spread only when you touch person body fluid directly.
Symptoms dey start quick, like flu or malaria: fever, headache, and body dey tire. As e dey go, person go begin vomit and get running stomach, and e fit cause organ failure. Some people go bleed inside and outside, but not all.

Richard Pebody, director for epidemic and emerging infections for UKHSA talk say:
"The risk to general public still dey low.
We transfer this person out of abundance of caution, and we happy say dem still dey alright."

The agency talk say for now, no confirmed case of Ebola dey UK.

Dis na di ogbonge waka we carry waka come today as E Dey Hot. As We Dey Waka, No Be Lie.

For advert contact WakacomeTV
Email:wakacometv@gmail.com 

Comments

Popular posts from this blog

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.