OPC warn President Buhari and Fulani herdsmen

Tori as we dey waka come:

OPC warn President Buhari, say dem support Sunday Igboho.
Dis Sunday na him Di Oodua pipu warn president Buhari say, dem no dey joke ontop dis matter at all, as him don make am clear say him dey support dis herdsmen wey dey enter villages dey kill pipu, dem say dis na warning, make dis herdsmen waka comot from yoruba kingdom.

Mr Wasiu Afolabi, Deputy President to the late OPC Founder, Dr Fredrick Fasehun, yan say, no Southerner go waka enter North go dey kill pipu, but why dis northern pipu dey enter pipu zone dey kill kill, and Nigeria President no dey yan ontop dis bad waka.

OPC talk inside Sunday Igboho matter, say na good thing Sunday waka do, to protect yoruba kingdom, say dem support Sunday, and make dem free Sunday from any arrest.

Odua pipu don halla give President Buhari say make him stop to dey take side on top dis killing wey herdsmen dey kill kill innocent pipu for insde dia land, Oodua don come outside with Amotekun to fit stop dis bad pipu wey dey kill pipu dey kidnap inside bush, dem talk aay na herdsmen be dis fulani pipu wey dey enter pipu village with AK47 and nikve, dem talk say dis pipu go start war with dis bad waka wey dem dey do so, and Nigeria security no won stop dem, di thing wey dey vex pipu bi say Iresident Buhari dey side dem with him security officials, dis na wetin dey make yoruba pipu dey parra, and OPC don ready to do di work wey Nigeria security don fail to help dem do, to protect dia pipu and land, from dis herdsmen.

wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.