Fraudulent Camera man

Tori As We Dey Waka Come:

Award winning and leading Director/Editor for Nigerian Film industry, don waka come outside to yan; him talk say one of him former worker wey him name na @fgbohunmi for Instagram, say him and him company no get any waka to do with this fgbohunmi.

Dis person wey him picture dey show on top we Tori na fgbohunmi, wey dey do magomago, that wan wey oyinbo dey call fraud, on top him former boss company name, him dey use am dey check mate people to dey collect money.
 
Mr Tosin Igho don talk say make every body stay away from dis fraudster wey dey do bad waka on top him company name, Oga tosin yan say him no get business with this person, make any body no go do business with this @fgbohunmi with him company name, say anything wey happen him no dey.

Oga Tosin yan talk say, "dis na public announcement for everybody, cos dis person wey una dey see, no get any business to do with me Tosin Igho, and remote picture, make una no go enter wahala for dis person hand, bcos @fgbohunmi no dey work for me again".


www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.