Court sentence 52years old man, wey steal, Infinix Phone.

Tori As We Dey Waka Come

On Friday inside Ogun state, one Court waka sentence, one man wey go steal infinix phone, dis man name na Usman Abfullahi, him be 52 years old.

Di Magistrates’ Court talk say make dis man go spend three months with Community Service inside prison.
Di name of di person wey sentence di man go prison na Magistrate Dehinde Dipeolu, but dem say di man dey beg dem say na devil hand work be dis, him say make dem pity am, as him be old man, him say make dem forgive am say him no go do am again.

Di police man wey catch am, talk inside the matter, him tell di court say na on di 19th of January, around 2pm, for Panseke area inside Abeokuta, dis man run enter Ibrahim Ogudipe shop, wey bi computer operator, him tell am say him wan buy Infinix hot9, for him hand, e no finish for dia, him enter another shop of Oluwasegun Olorunmade wey be tailor,  E lie for dis tailor aay him need to arrange cloth for am, na so him take carry phone waka dey go.



www.wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Opmerkings

Gewilde plasings van hierdie blog

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Tinubu A.K.A Jagaban Don collect Certificate Of Return with him vice

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.