(AUFCDN) Don Call Off Dia Nation-Wide Strike for we Kontri.
Tori As We Dey Waka Come:
Amalgamated Union of Foodstuff and Cattle Dealers of Nigeria (AUFCDN) don call off dia nationwide strike for we kontri.
Di waka happen On Wednesday after dem yan di matter with di Federal Government wey dey represent by Kogi State Governor, Yahaya Bello.
Di presido of AUFCDN, Muhammad Tahir, talk say dem decide to call off di strike after government promise to pay di N4.75billion dem demand as compensation, ensure protection of dia members and stop all forms of multiple taxation on di highways.
Governor of Kogi State, Yahaya Bello bin don beg di Union to end di strike, as e promise to follow up and ensure say government meet di union demand.
Tahir say: "All di stakeholders and members of AUFCDN in our nationwide strike dey glad say we achieve wetin we bin wan achieve. Since di Governor of kogi state, Yahaya Bello beg us on behalf of di government, we agree to call off di nationwide strike today.
"Dem agree to pay di compensation and call off any multiple taxation ontop di federal highway and allow us to engage in our business activities peacefully nationwide.
Yahaya bin tok say di nationwide strike cause hardship for majority of Nigerians wey already dey go through a lot, including for members of di aggrieved union.
According to am, di prices of foodstuffs and cattle increase by 100 percent for di south and west. E add say di North also hear am as perishable goods bin dey rotten and both farmers and truck drivers no fit carry out business transactions.
To dis end, e bin appeal to di aggrieved union to immediately call off di strike and allow movement of foodstuffs and cattle to all parts of di kontri, especially di north and southern parts.
Governor Yahaya Bello don assure di union of di commitment of leadership for di south and west.

wakacometv.blogspot.com
send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.
As We Dey Waka, No Be Lie.
#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments
Post a Comment