Covid19: See Who Go Collect Di 3.92 Million Doses Qf Di AstraZeneca Vaccine Wey Just Enter Nigeria.

Tori As We Dey Waka Come:


Picture of di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine wey just enter Nigeria.
AstraZeneca vaccines don enter we kontri Nigeria, dis go make Nigeria di next West African kontri to collect di COVAX Facility after Cote d'Ivoire and Ghana.
Di arrival of di vaccine go enable dem begin vaccinate Nigerians in priority groups, starting with di frontline health workers, na so NPHCDA talk.
At all levels, di cold chain facilities wey dem go store di vaccine don dey ready.



Mr Osagie Ehanire wey be di Minister of Health for we kontri Nigeria, don receive di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine as e arrive di kontri capital, Abuja yesterday.
Dem don dey train all di health workers wey go administer di vaccination, na so di National Primary Health Care Development Agency, yan inside statement wey di World Health Organization and UNICEF join body do.

wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Dis Christmas ogbonge awoof promo