Fatgbems Filling Station Sell Water to Customers in Disguise as Petrol Price Don Enter N212.

Tori As We Dey Waka Come: 


Di matter happen on Sunday 14th of March for Abeokuta, Southwest Nigeria within di same period wen fuel price hike bin happen for all filling stations across di kontri.

Di matter don cast for social media, inside one video wey customer notice say na water dem sell give am, plenty pipo don come back to confirm di matter wey make dem car engine get fault.



Dis video wey dey trend for social media show where some customers dey lament and accuse di filling station of cheating - di video also show where some car owners dey check dia vehicles to find how to comot di water from dia engine.


Di management of Fatgbems filling station for di statement wey dem bring out tok say wetin make dia nozzle pump water instead of fuel na because of "water overflow into one of di station storage tanks."
E talk inside statement say, "Fatgbems go like tok am again say di unfortunate incident dey against as we dey take do business as we no go use our mind sell low quality products to our customers.


wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Dis Christmas ogbonge awoof promo