Zamfara kidnapping: Gunmen Abduct 300 plus Jangebe Government Secondary School Girls.

Tori As We Dey Waka Come: 


Di Zamfara state police command don confirm di abduction of 300 plus students wey gunmen kidnap from dia boarding secondary school early today for di town of Jangebe, for Zamfara state.

Father of one of di kidnapped Jangebe students say: E dey pain me say I no follow go visit my pikin di last time.

Father of one of di kidnapped students for Government Girls Secondary School Jangebe don share im pain and how E feel wen news of him daughters kidnap reach im ear.

Mohammed Rilwanu talk say two of im daughters dey among di 300 plus students wey gunmen kidnap from Government Girls Secondary School Jangebe on Friday the 26th.

E talk say since di news of di daughters kidnap reach am, for hours now wetin dey im mind na how e no follow go visit dem last month during di school visiting day.

Him bin receive phone call about wetin happen for di school around 1:45am till 3am and by di time im reach there some parents don dey there but by den di gunmen don pack di students go, na just school authority dey try check who and who dey miss inside school.

Security don take over di school dem dey ask all parents and staff to go outside so dat investigations go continue.

Mr Mohammed Rilwanu talk say di mood for Jangebe town right now na sad one as every corner na di same discussion but dem use Friday muslim prayers pray for di release of di students.

Khadija Abubakar picture 

16 years old Khadija Abubakar, dey among di student wey dem kidnap.



wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria