Orlu crisis: Nigerian Army send helicopter go Orlu.

Tori As We Dey WakaCome: 



Military dey do air strike for Orlu as we dey see inside dis video Nigeria Military helicopter go Orlu town, for Imo State, southeast of Nigeria.
Three weeks ago, jaguda pipo do shooting for di area kill pipo and burn some houses.




E dey on top all social media for Nigeria on top dis matter wey dey hot for Orlu, some local tori pipo dey report say Nigeria Military dey conduct air strikes for Orlu as dem dey try catch members of Eastern Security Network (ESN). Different video of this matter dey sup on top twitter, Instagram and Facebook.
 
Helicopter fly pass dem as e fly out of di view of di video you fit hear gun shot. One man voice dey shout, "ha! Jesus Christ o! wia dis one dey? Ha! Why dis pipo dey waka upandan abeg? Why dis pipo dey… Jesus see gun. Ha!... make everybody enta...

See di video:




wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Dis Christmas ogbonge awoof promo