CBN bans cryptocurrency: Davido and plenty pipo dey parra on top dis matter.

Tori As We Dey Waka Come:


Davido express shock and say dis matter na just three days afta im bin tell all him fans on twitter about plans to go into cryptocurrency

"Wooooooow only took 3 days" Davido tweet

 Central Bank of Nigeria, don yan why dem place restrictions on top cryptocurrencies for all banks wey dey di Nigeria.

Dem yan am inside statement wey di Acting Director, Corporate Communications Osita Nwanisobi sign on Sunday evening, di Apex bank for Nigeria say dem don already forbid all commercial banks wey dey di kontri from trading or transacting since 2017.

CBN mention say some oda kontries like China, Canada, Taiwan, Indonesia, Algeria, Egypt, Morocco, Bolivia, Kyrgyzstan, Ecuador, Saudi Arabia, Jordan, Iran, Bangladesh, Nepal and Cambodia, don ban dis cryptocurrenecy trading sake of say dem fit dey use am for financing terrorist, launder money and do some kain bad things.



Apex bank for di kontri however assure say dia actions no be to affect any technology-driven payment system or form inimical to di development of FinTech.

CBN say di reason why em make dia recent regulatory directive na to protect di financial system and we kontri pipo including di youths from di risks wey dey inside crypto assets transactions.

We Nigeria Entertainer Davido, wey bin tweet on 2nd February, 2021 say im dey think about starting Bitcoin trading company, surprise to see CBN recent reminder to bank on crytocurrency traders account.


wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria