Oyo state Ibadan: Yoruba vs Hausa clash inside Shasha.

Tori As We Dey Waka Come:





For statement wey di chief press secretary to Governor Seyi Makinde, Mr. Taiwo Adisa, drop, im say dem set di curfew make law and order no dabaru for di area as dem also set for Shasha and di market area.

Di curfew time go be from 6pm to 7am.



Dis na videos of some place for Shasha.

Di popular Shasha Market, for Ibadan, Oyo state South West Nigeria after youths from both di Hausa and Yoruba communities fight.

According to local tori pipo, na misunderstanding start di mata and na so di two tribes start fight.
Inside Shasha 50 shops and plenti goods and property don spoil finish, before security waka come.

Dem even tiff from some shops & houses.

Oyo state governor Seyi Makinde don order curfew for di area

Di Oyo State government don order di sharpaly closing of Shasha market for Akinyele Local Goment Area of Ibadan.




Inside di statement, dem drag ear give warning to residents for di area say make dem run dia legal and legit business peacefully, as dem add say anyone wey chook hand for violence go smell pepper from di wrath of di law.


wakacometv.blogspot.com
send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.
As We Dey Waka, No Be Lie.
#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria