Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher

Tori As We Dey Waka Come:



Government Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher wey tell her to barb her hair.

Dis Government Secondary School girl carry one local made gun enter School for Akpabuyo, Ikot Ewa Cross River State to shoot her teacher because im tell her to cut hair hair.

Dis matter happen for Community Secondary School Ikot Ewa for Akpabuyo, Cross River State, last week Thursday.

E happen say, as di young girl resume school, her class teacher tell am say make she go barb her hair wey she carry come school.
Dis na becos, so school for Cross River, students no dey carry grown hair come school as dem get dat kind rule, she gast go back house.
Di next day she waka come school wit local gun.

Di School Principal raise alarm. Pipo around come hold her and teachers, students all come out to see wetin dey sup for school.

One person wey see as di matter happen yan say  im go visit im friend wey dey stay close to school wen dem hear di alarm rush go see wetin dey happen for di school so im come snap di girl wit di gun.

im say dem try to find out how she get di gun and she carry dem go one man.

"Dem discover say dis man dey totori her body for bed and na from di man hand she get di local gun."

Dem don carry di girl go security authorities for further investigation.

Dis person wey do this waka, we see as everything take happen, na him snap picture of di girl with local gun wey come begin trend for social media as pipo dey marvel how di young girl carry gun go school to shoot her class
teacher.



wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria