Kaduna state: Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church.

Tori As We Dey WakaCome: 


Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church, and two homes, inside Kikwari village, Kajuru local government area for Kaduna state.

Samuel Aruwan, Commissioner, Ministry of Internal Security and Home Affairs, Kaduna State, talk on Sunday, say pipo run com or for di area when di gbege start, as dem receive information say bandits dey outside di village.

Di armed bandits burn di church and two houses.

Di Governor El-Rufai feel very bad, him talk say him go use him office to give protection and hellep to provide for di pipo and continue to work hard to fight against banditry and other crimes.

Him tell worshippers to remain strong in their faith and devotion, and to see dis as an act perpetrated by enemies of peace, humanity and diversity wey no go succeed but will be defeated by the grace of God.

Di Governor don direct di Kaduna State Emergency Management Agency to urgently assess the damage done and take appropriate action.



wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria