Flood water kill pipu for Yenagoa, di Bayelsa State capital inside Nigeria

Tori As We Dey WakaCome:

How di death of 16 year old Temedi 

Yerimene wey drown becos of flooding for Igbogene community for Yenagoa, di Bayelsa State capital, Southern Nigeria na one of di major losses pipo dey count for di flood palava Nigeria dey suffer so.


Di boy na from Amabulu in Ojobo community of Ekeremor LGA of Bayelsa but di family dey live for Igbogene.


Tori be say di flood push di young boy into di deep canal for di area wen im and im friends go swim for di flood water close to di Bayelsa Ecumenical Centre. Mama of di boy, Yerimene

Waka Come yan say di incident happen on Monday 10 October 2022 around 11am in di morning wen im go swimming.


"I come back from market and dem tell me say im go swim. I bin think say im go swim for di water wey dey flood for our compound until one of im friends tell me say na di flood drag am into di canal."


Efforts by di community search party wey go search for di boy no dey successful but na on Wednesday 12 October, 2022 dem find im deadibody as e float out.


Dis don add to di 500 pesins wey di National Emergency Management Agency NEMA say don die sake of di flooding disaster for Nigeria dis year 2022.



As we dey waka, no be lie.

send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com

Follow us on top Instagram @wakacometv

Follow usom top twitter @wakacometv

Follow us on top Facebook @wakacometv

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria