Lagos Bus Driver on strike - Governor beg for meeting to see them on Wednesday.
Tori As We Dey WakaCome:
No be small gbege as pipu bin dey stranded for bus stop inside lagos, for early mor mor of today wey bi Monday 31st of October 2022, based on say commercial bus drivers under the umbrella of the Joint body Drivers’ Welfare Association of Nigeria (JDWAN) bin start seven-days strike because of anyhow extortion wey government officials dey do them.
On dis strike waka, na so di transportation money waka come up...as pipu con dey pay plenty money to fit waka go dem destinations.
From Ijaiye to Oshodi wey be N400, before don increase to N700 While transport money From Ijaiye to Agege waka come up to N400 instead of N200 naira.
As E Dey Hot On top Dis Transportation waka
The Lagos State Government don call the ogas dem for Joint Drivers Welfare Association of Nigeria, JDWAN, to do meeting on Wednesday, 2nd of November so that dem go fit find solutions to everything wey dem dey ginger for.
dis na di list of pipu wey do dis. Strike waka DWAN and other transport unions wey be: Ibile Drivers Stakeholders Association of Nigeria -DSWAN, Mega City Drivers Welfare Association of Nigeria-MCDWA, Federal Assisted Mass Transit Incorporation-FAMTI, Owners, Drivers and Conductors Association-ODCA, Commercial Bus Drivers and Owners Operators of Lagos-CBDOP, and Mini Bus Drivers Welfare Association-MNDWA, bin start seven day warning strike so that they go fit to put eye for all the sufferings wey dem dey face.
My name na Evangelist Oladipupo dis
Na di tori wey I carry waka come.
As we dey waka, no be lie.
Remember to follow us on top we social media page.
Facebook @wakacometv
Instagram @wakacometv
Follow us on top
twitter @wakacometv
You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv
If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or
send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com
As we dey waka, no be lie.
Comments
Post a Comment