Waka on top Yelwata community in Benue State.
Dis Na Tori, As We Dey Waka Come:
Waka on top Yelwata community in Benue State.
Nigerian President Bola Tinubu go Waka come Benue State on Wednesday to console di families of pipo wey dey affected for di recent violent attacks wey happun for Yelwata community in Benue State.
Presido yan dis Tori during one ceremony for Abuja on Monday to commission water projects wey Minister for di Federal Capital Territory Nyesom Wike construct.
As e dey tok for dat occasion, Tinubu say: "We gatz be able to manage our anger and frustrations. I sympathise wit di pipo wey lose dia lives. I go adjust my programme and go see Benue pipo on Wednesday."
Later, di tok-tok pesin for di President, Bayo Onanuga, release statement wey clarify say Tinubu bin suppose visit Kaduna State, but e don reschedule am, instead e go travel to Benue State "as part of renewed efforts to foster peace and address di persistent conflict affecting communities for di state".
Govnor of Benue State Hyacinth Alia na im lead di security chiefs to di community wia more dan 100 pipo die following attacks by gunmen for di midnigh and early morning of Saturday, 14 June, 2025.
Di IGP describe di attack as "senseless and an act of terrorism", and e promise say di Nigeria Police Force do dia best to bring di attackers to justice.
Also, di CDS assure di pipo say dis go be di last attack wey go happen for dia community.
"We want make dis one be di last one wey go happen. We go go all out to ensure say we address am. We don put measures for oda places and e bin work, so here no go dey different," e tok.
"I wan assure Nigerians say no be only Benue State, all ova di kontri, we dey determined, based on di mandate of Mr President, to make sure say we restore peace and tranquility inside our country, but we need Nigerians to support us."
Guvnor Alia thank di security chiefs wey visit and say e dey happy wit di deployment of more troops to di state.
Comments
Post a Comment