Carter Efe use Portable do suya o! officer wo's dey yan
Tori As We Dey Waka Come:
As E Dey Hot!
E be like say Wahala no dey finish for Zazuuu master o! Yes o, na Portable we dey talk! Dem carry am go boxing ring for Chaos in the Ring 4 last weekend for Balmoral Hall, Lagos. Dem say make him fight Carter Efe — dat skit maker wey tall like NEPA pole!
Chai! Kasala don burst! Carter Efe use Portable do suya o! All three judges talk say 30-27, 30-27, 30-27. Clean mouth! No argument! Portable wey dey shout “I be street” since, body come tell am say gym no be beans. By round two, him hand don dey shake like person wey cold catch. Round three, gbim — stamina finish!
But wait, na di gist wey sweet pass be dis: Afta di fight, Officer Woos come online come drop bomb! Him talk say, “No musician support Portable… ahnahn why now?” Ha! Social media scatter! People come dey ask: “Shey na because Portable don too fight everybody for industry? Shey na because him don yab Olamide before?” Food for thought o!
Meanwhile, Carter Efe dey cash out big time! E-Money give am — ₦50 million gbam for di boy! Even Victor Boniface say make him come Germany go chill. Carter come dey call himself “Carter Mayweather” now o! Pride dey worry am!
But Portable? Dat guy no dey carry last! Even as dem lick am for ring, him don already call another fight! Dis time na Habby Forex him want collect ₦300 million from for Independence Day. Zazuu no dey tire!
Him still dey para say dem “rob” am. Him talk say Carter Efe dey use long hand strangle am, say dem no count all him punches. But him come yarn one sense: “My wife just born. Pikin pass belt.” At least na true talk be dat one.
So my people, di question be say: Why no musician stand for Portable? Na him wahala too much? Or industry just wicked?
As we dey waka, no be lie.
IF you get Tori for us, send am to we email: wakacometv@gmail.com
For every tori we go dey give you better money. 7890

Comments
Post a Comment