Gunmen Attack Prison for Owerri on Monday.

Tori As We Dey Waka Come:

Gunmen on Monday April 5th 2021, attack di Nigerian Correctional Services (NCS) for Owerri, Imo state capital for South East Nigeria.

According to di tori, E happun around midnight and e never clear well well if prisoners escape from di prison.

Na About 30 vehicles na im di gunmen burn down inside di police headquarters wey dey di same area.

Di police headquarters dey opposite di Imo state government house.

E no dey clear who carry out di attack at di moment.

Dis no be di first time hoodlums dey attack prison officials and dia facility for Imo State.

IGP for di statement wey im tok tok person CP Frank Mba, release say "di attempt by di attackers to gain access to where Police dey keep dia weapons for di Headquarters fail as officers wey dey on duty no allow dem.

Di place where Police dey keep dia weapons dey intact and di police no record any death apart from di Police constable wey sustain minor bullet wound for im shoulder.

"Di IGP don direct di Commissioner of Police, Imo State Command and one new Special Investigation Team (wey dem set up specifically to deal with cases of incessant attacks on security formation/operatives for di region), to carry out holistic investigations into di incident with di aim to arrest di pipo wey carry out di arrest."

Imo State Governor Hope Uzodimma don tok say government go rise to di challenge wey members of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and Eastern Security Network (ESN) don carry come.

Governor Uzodimma tok dis one during im interview with tori pipo for Owerri after im inspect di level of damage wey happen for di attack.

Dis na di second major attack for Imo State this 2021 - On January 25, 2021, dis same gunmen carry attack go Orlu where dem kill some traders and soldiers.

Nigerian troops for one joint operation wey involve Army, Air Force and di Police carry fight go meet di armed IPOB members after in response to di Orlu incident.

But on top dis latest attack Governor Uzodimma say, "di level of gangsterism of IPOB and ESN members dey unacceptable. Pipo wey get conscience don condemn dis attack. I don already commission investigation into wetin happen for di incident." 



wakacometv.blogspot.com

send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

As We Dey Waka, No Be Lie.

#wakacometv #toriaswedewakacome

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria