SEUN KUTI DON ENTER WAHALA FOR OLOPA MATA

Tori As We Dey Waka Come: 



 Oga of Dem Olopa don call for di arrest of Nigerian Afrobeat singer, Seun Kuti over alleged assault olopa.

IGP Usman Alkali Baba direct di commissioner of police for Lagos state to sharparly arrest di musician after one viral video show am wia im dey assault one olopa.

Seun, 40, son of lengendary activist and musician Fela Kuti inside di video slap di officer wey dey in uniform while pipo watch inside dia moto.



Inside statement on Sunday night, di oga kpatakpata of olopa for Nigeria ''order for di full investigate into di remote and immediate cause(s) of di assault and prosecution of di suspect accordingly.''

E no dey clear wetin cause di wahala but Oga Kuti for one Instagram post claim say di officer bin wan ''kill me and my family''.



Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 
If you get Tori, send am to we Email: 
wakacometv@gmail.com 
As We Dey Waka, No Be Lie. 

Comments

Popular posts from this blog

India plane wey dey head to London crash wit over 200 pipo onboard

See As Person Pikin And Im Friends Die When Dem Drink Zakami Drink Inside Wedding

Waka on top Yelwata community in Benue State.