clubs wey fit qualify for Europe Premier league

 Tori As We Dey Waka Come: Sport Waka



Di Champions League race bin look settled but Liverpool seven straight wins don drag dem back enta di race again.


Manchester City and Arsenal already dey guaranteed to finish for di top four and Newcastle and Manchester United dey most likely to join dem dia.



But, Liverpool now dey one point behind we no say dem don play one game more dan di Magpies and Red Devils.


pipo no think say e dey possible but if dem slip, we gatz dey dia," manager Jurgen Klopp tok.

"Dem go slip? I no know. We fit win both games? I no know."



Di teams wey finish for di top seven go secure European football next season anchester City, wey fit win di Champions League dis season, 

and Arsenal, wit dia current totals of 85 and 81 points respectively, go finish as di top two.


City go win di league if dem beat Chelsea on Sunday (16:00 BST).


Newcastle and Manchester United occupy third and fourth place respectively, na only goal difference dey separate dem, on 66 points.


Dem be strong favourites to clinch di two remaining Champions League spots - but both sides don only win one of dia past three games.


At di same time Liverpool, wey bin dey dey 12 points behind dis two teams as of April 9, don finally find dia form to move to just within a point.


According to data experts Nielsen Gracenote, di chances of qualifying for di Champions League don go up from 12% to 45% in just under three weeks.


Meanwhile Newcastle, don see dia chances slip from 91% to 74% afta dia 2-0 loss to Arsenal and Saturday 2-2 draw to Leeds.


Mathematically Brighton no dey out of di race but dem go need a lot of tins to go dia way to get a chance.


If Manchester City go on to win di Champions League, whoever finish fifth for Premier League no go qualify for next year competition sake of dat.



Di only circumstances under which five English teams fit qualify for di Champions League na if a Premier League club win di competition,

but then fail to finish inside di top four for league.




Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 

If you get Tori, send am to we Email: 

wakacometv@gmail.com 

As We Dey Waka, No Be Lie. 

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.