Obodo Oyinbo Museum Wey Waka Come Carry Ghana Gold For Asante Don Yan Say Dem Go Like Borrow Am Back From Asante Palace

 Tori As We Dey Waka Come:



Di ruler of Ghana Asante pipo don ask British Museum to return gold items wey dey dia hands to im kontri.

Di Asantehene, Otumfuo Osei Tutu II, recently meet di museum director Dr Hartwig Fischer for discussions.

Di items wey dey di museum hand include work wey di British take from Asante palace for Kumasi during war wit di British for 1874.

Di British Museum tell tori pipo say im dey "explore di possibility of borrowing di items" to Ghana.

Di Ghana ruler meet Dr Fischer last week, afta im di Coronation of King Charles.



Ghana goment don set up Restitution Committee to torchlight di returning of items wey dem take from Asante Palace wey now dey for different pipo and institutions hand around di world.

Nana Oforiatta Ayim, wey dey di committee, tell tori pipo say: "Dis objects na mainly sacred ones and dia return no be just about restitution. Na also about reparation and repair, for places wia dem from take dem, but also di pipo wey do di taking."



She add say dem dey look for new relationship "wey no dey based on exploitation or oppression, but on equity and mutual respect".

Last Thursday discussions for di British Museum na di first ever meeting between di Asantehene and di museum director Dr Fischer.

According to di British Museum, Asantehene ask make dem loan am items wey be symbols of office belonging to im forefathers.

For di 19th Century, di Asante state bin be one of di few African states wey seriously resist di European colonisers.



Im independence end for 1874 wen one British expeditionary force march enta Kumasi to revenge one tok tok pesin for di British Museum tell tori pipo: "Our director and deputy director bin happy to welcome His Royal Majesty Osei Tutu II (di Asantehene) to di museum during im visit to di UK for di Coronation of King Charles III."

She add say di British Museum "dey explore di possibility of lending items from di collection to mark the 150th anniversary of di end of di third Anglo-Asante war, as well as to support celebrations for Asantehene Silver Jubilee next year".

For some Ghana pipo however, loans no ever fit be long term solution.

Oforiatta Ayim, wey also be special adviser to Ghana Culture Minister, say: "Loans fit be di first step as pas say dem go fit open tok tok for di kain of institutions and structures wey dey slow to change.




Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 

If you get Tori, send am to we Email: 

wakacometv@gmail.com 

As We Dey Waka, No Be Lie. 

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.