Nigeria President Elect: Bola Ahmed Tinubu on phone call with Anthony Blinken Di US Secretary of State.

Tori As We Dey Waka Come:



Di United States Secretary of State Antony Blinken emphasis im commitment to continue strengthen di relationship between Nigeria and im kontri for di new govment wey go soon enta office.

Oga Blinken give dis assurance during im first official phone call to Nigeria president-elect Bola Ahmed Tinubu on Tuesday.



Di Secretary yan say US-Nigeria relationship don go way back and say dis relationship dem build am on " shared interest and strong pipo-to-pipo waka come ontop im want make dis links continue to dey stronger under Bola Ahmed Tinubu govment.



Di two also discuss why e dey important for di leadership for Bola Ahmed Tinubu govment to represent all Nigerians and to promote security cooperation and policies wey go support economic growth.

Dis call between Blinken and Bola Ahmed Tinubu dey occur less dan two weeks to di swear-in.


According to Tunde Rahman, wey be Bola Ahmed Tinubu talk talk persin, na di US diplomat initiate di conversation wit di president-elect.

"Di telephone discussion, wey dey frank and friendly, happun on Tuesday evening," Rahman tok inside one statement.

"While affirming im democratic bona fides , President-elect Bola Ahmed Tinubu express im absolute belief say di result of di elections, wey he clearly win, reflect di will of di Nigerian pipo.





Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 

If you get Tori, send am to we Email: 

wakacometv@gmail.com 

As We Dey Waka, No Be Lie. 


Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.