Naira Note wahala inside Nigeria
Tori As We Dey Waka Come:
As E Dey Hot, On Sunday Kano state goment shutdown popular supermarket, Welcare ova accusation say dem dey reject old naira notes even though Supreme Court give order say make pipo continue dey use am.
After di shutdown, some Kano state goment officials also comot on social media dey ask pipo to name shops or businesses for dia area wey dey also reject old naira notes so dat dem go suffer di same fate as Welcare.
Dis follow di end of di deadline wey di Central bank of Nigeria set for di old naira notes to be legal tenders for Nigeria following di naira redesign policy.
Acting chairmam of Kano consumer protection council, Baffa Dan Agundi, wey carry out di shutdown order, tok say govnor Abdullahi Ganduje yarn say anybody wey no collect old naira notes dey violate wetin Supreme court tok.
Dis na action wey go continue as Senior Special Assistant to di govnor on new media Abubakar Ibrahim ask pipo for social media to send addresses of businesses wey no gree collect old naira notes so dat action go follow.
Across di state many oda businesses dey continue to collect and do dia businesses without any problem.
Dis na di tori wey we carry waka come.
As we dey waka, no be lie.
Remember to follow us on top we social media page.
Facebook @wakacometv
Instagram @wakacometv
Follow us on top
twitter @wakacometv
You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv
If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or
send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com
As we dey waka, no be lie.
đŸ’¯
ReplyDeleteOkay
ReplyDeleteNew Nigerian money dey shine
ReplyDelete