Posts

Showing posts from March, 2022

NIGERIA: Abuja-Kaduna train wey bandit attack

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis na di picture of di Abuja-Kaduna train wey bandit attack, dem kidnap some passengers. Two cleaners and workers wey dey work inside di train, Loretta and Abdul die with some security personals and some passengers die plenty pipo injure and dem kidnap some pipo.  Dis train dey carry 970 passengers. Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.

LAGOS STATE Apongbo bridge on fire dis early mor-mor.

Image
Tori As We Dey Waka Come: LAGOS STATE Apongbo bridge on fire dis early mor-mor. Today wey be Wednesday 23rd of March dis morning na him fire outbreak don destroy plenti shops for Apongbon area of Lagos State. Click on this link to see the full video... Apongbon bridge on fire Dis na photo from di scene of di fire outbreak for Apongbon area of Lagos state, Southwest Nigeria.  Pipo property and plenti shops wey dey under di bridge fire don waka enter burn am destroy. For now, E never  dey clear yet wetin cause di fire, but we hear say di fire dey affect di bridge. Motor wey dey waka true di route dey advised to take alternative roads.  Fire fighters dem don already waka come to help stop di fire. Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.