Posts

Showing posts from June, 2025

Waka on top Yelwata community in Benue State.

Image
    Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: Waka on top  Yelwata community in  Benue State . Nigerian President Bola Tinubu go Waka come Benue State on Wednesday to console di families of pipo wey dey affected for di recent violent attacks wey happun for Yelwata community in Benue State. Presido yan dis Tori during one ceremony for Abuja on Monday to commission water projects wey Minister for di Federal Capital Territory Nyesom Wike construct.  As e dey tok for dat occasion, Tinubu say: "We gatz be able to manage our anger and frustrations. I sympathise wit di pipo wey lose dia lives. I go adjust my programme and go see Benue pipo on Wednesday."  Later, di tok-tok pesin for di President, Bayo Onanuga, release statement wey clarify say Tinubu bin suppose visit Kaduna State, but e don reschedule am, instead e go travel to Benue State "as part of renewed efforts to foster peace and address di persistent conflict affecting communities for di state". Govnor of Benue S...

herdsmen attack for Benue state

Image
  Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: Play video herdsmen attack for Benue state  attack don lead to di death of many villagers for Benue State, North central Nigeria. Di attack happun for Yelwata, a Benue border town wit Nasarawa state wia suspected armed herdsmen attack di pipo on Friday night. Authorities don confam di incident. Benue state govnor Hyacinth Alia condemn di attacks and killing of innocent citizens for Yelewata, say ''nobody get right to take anoda pesin life'' Officials say at least 45 pipo die during di overnight attack for central Nigeria. But local sources say di number high pass this one. Eyewitnesses say na armed cattle herdsmen carry out di attack and police say dem engage di attackers for gun battle. Dem burn down many houses for di raid on Yelewata town. "Di police and tactical teams wey dey di town and reinforcement respond sharpaly to di attack and engage di attackers for serious shoot out and some of di attackers di in di process", B...

Dem assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal

Image
  Play video Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: Dem assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal Una welcome to dis ogbonge Waka, wey we carry waka come, my name na KAYDI. Olopa yan say Albert Ojwang "sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall". Im death don spark widespread outrage for Kenya, as rights groups dey demand say make authorities hold police accountable. Dem detain 31-year-old Ojwang afta one complaint by di deputy police chief, wey dem accuse say e tarnish im name on social media. "Di cause of death dey very clear; head injury, neck compression and oda injuries spread all ova di body and dat dey point towards assault," state pathologist Bernard Midia tok. AS HE DEY HOT: Olopa arrest Oga Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, sake of one post e make on X wey allegedly dey critical of Deputy Inspector General of Police Eliud Lagat. Dem later transfer am go di capital, Nairobi, wey dey ova 350km (220 miles) from ...

India plane wey dey head to London crash wit over 200 pipo onboard

Image
  Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: India plane wey dey head to London crash wit over 200 pipo onboard Play video Una welcome to dis ogbonge Waka, wey we carry waka come, my name na KAYDI. Di plane wey dey head to London crash small time afta e take-off for Ahmedabad, western India.  One senior police officer for Ahmedabad tell ANI news agency say di London-bound plane crash inside one doctors hostel, wey be accommodation for local medical professionals. E say police, firefighters and oda civic workers reach di spot within minutes. Rescue operations still dey go on. Ambulances dey all over di area. Roads dey blocked. Emergency response teams dey try to quench di fire. Officials don confam say na 242 passengers and 12 crew members na im dey onboard di Air India plane wey crash. Faiz Ahmed Kidwai, chief of India directorate of civil aviation, tell di Associated Press say di plane crash inside one residential area called Meghani Nagar.

WAHALA WAY HAPPEN BETWEEN ISRAEL AND IRAN.

Image
  Dis Na Tori, As We Dey Waka Come: Play video YESTERDAY NIGHT WEY BE 13TH OF JUNE 2025 NA HIM DIS WAHALA SHELE, BETWEEN ISRAEL AND IRAN. THIS ONE NO BE KNOCK-OUT WEY DEY FLY FOR NIGHT, NA MISSILES DEM DEY CALL AM. Una welcome to dis ogbonge Waka, wey we carry waka come, my name na KAYDI. Dis attack dey come in retaliation for Israel overnight attack on Iran. For one statement, Israeli military say dem don tell kontri pipo to hide for shelter until further noticed.  Huge smoke bin rise above Tel Aviv for Israel, around skyscrapers for di city. Di smoke cover di tall buildings around am. E neva clear if di burning na from di missiles, or di interceptions.  Iran Supreme Leader Ali Khamenei don tok say Iran "go inflict heavy blows" afta Israel "launch war". E warn say Iranian forces go "act wit strength" against Israel. Di Supreme leader bin post on X, say dem no "go escape unscathed from dis crime". "Di Iranian nation fit dey assured say short...