Posts

Showing posts from July, 2024

Bomb wey kill pipu inside Bornu State Nigeria

Image
  TORI AS WE DEY WAKA COME:  Police for Borno State, northeast Nigeria, don confam di two suicide bomb attacks wey kill nine pipo for Gwoza local goment area of di state. Tok-tok pesin for di police in di state ASP Nahum Daso yan say, Di first attack bin shele wen one female suicide bomber wey carry pikin detonate bomb  for di popular Mararaba T Junction for Gwoza. E say na about 3pm e happun and majority of di pipo wey experience di attack bin dey come from wedding ceremony. Di wedding celebration dey sweet and pipo bin dey come back from different places. Di junction particularly na veri busy place, although majority of di pipo for dia bin dey come back from wedding celebration and all. ASP Daso say di second attack happun wen dem bin dey do prayer for di burial of pipo wey die for di first attack. According to di police officer, barely two hours afta di first attack, anoda female suicide bomber detonate bomb, and kill one pesin including herself and injure odas. Click to play Video

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria

Image
  Tori As We Dey Waka Come Nigeria on 'high risk on top cholera As E dey Hot on top Dis Cholera gbege Di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don activate national cholera emergency operation center. Di declaration afta sabi pipo on mata wey concern cholera do one ogbonge risk assessment on top di Cholera situation for Nigeria last week. Di centre say based on di assessment na im make dem activate di National Cholera Multi-Sectoral Emergency Operations Centre (EOC)  for di FCT and all di states for Nigeria. Dis decision to activate di cholera emergency centres di NCDC say, na to show di gravity of di outbreak and to reduce di impact of di disease. CLICK TO PLAY VIDEO Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie. 

NEMA Welcome back Japa Nigerians wey dem Drive come back

Image
 Tori As We Dey Waka Come: We Japa Pipu Don waka come back Nigeria by force, dis waka happen after dem remove dem comort for di obodo oyinbo land wey dem waka waka go. as e dey hot on top dis waka, wey dem remove dis nigeria wey japa go obodo oyinbo land come back,  for inside Abuja Airport for we country nigeria, NEMA Welcome dem back to we mother land. Di pipu we follow welcome dem back na di Director General NEMA, Mrs Zubaida Umar,DG NEMA,  person wey repreaent Di Director, North Central Zone, Alhaji Bashir Garga,follow welcome dem say make dem feel at home,  say we Goverment go assist dem for money to fit helep dem waka go dem house inside we country plus ogbonge help wey dem go fit do for dem. CLICK TO PLAY VIDEO Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie.  and kill one pesin including herself and injure odas.

MR IBU Burial

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Popular Nollywood Actor MR John Okafor Popularly called MR IBU, wey dem burie on di 28th of June 2024, na great Noollywood Actor, wey dei on di 2nd of march 2024, afta im battle one "strange and dangerous illness. Na im Burial dem just do finish for him home town inside Eziokwe Amuri, Nkanu West Local Government Enugu State. CLICK TO PLAY Dis na Tori As We Dey, Waka Come.  If you get Tori, send am to we Email:  wakacometv@gmail.com  As We Dey Waka, No Be Lie.