Bomb wey kill pipu inside Bornu State Nigeria

 

TORI AS WE DEY WAKA COME: 

Police for Borno State, northeast Nigeria, don confam di two suicide bomb attacks

wey kill nine pipo for Gwoza local goment area of di state.

Tok-tok pesin for di police in di state ASP Nahum Daso yan say,

Di first attack bin shele wen one female suicide bomber wey carry pikin detonate bomb 





for di popular Mararaba T Junction for Gwoza.

E say na about 3pm e happun and majority of di pipo wey experience di attack bin dey come from wedding ceremony.

Di wedding celebration dey sweet and pipo bin dey come back from different places. Di junction particularly na veri busy place,

although majority of di pipo for dia bin dey come back from wedding celebration and all.

ASP Daso say di second attack happun wen dem bin dey do prayer for di burial of pipo wey die for di first attack.

According to di police officer, barely two hours afta di first attack, anoda female suicide bomber detonate bomb,

and kill one pesin including herself and injure odas.



Click to play Video



Dis na Tori As We Dey, Waka Come. 
If you get Tori, send am to we Email: 
wakacometv@gmail.com 
As We Dey Waka, No Be Lie. 

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.