JUSTIS FOR OCHANYA ELIZABETH OGBANYA
TORI AS WE DEY WAKA COME: Di death of Young and promising Nigerian child Ochanya dey veri young wen she bin comot for her parent house. Na school Ochanya find reach her aunty Felicia Ogbuja house and evritin first dey go on well for about four years until di mata begin take anoda turn. Ochanya live wit di Ogbujas (Aunty Felicia plus her husband Andrew and five of dia pikin) for di same house for four years. "Na for 2012, Ochanya sickness start. We carry am go hospital for Okpoga. Na for dia we stay reach about six days and she get medical attention. As time pass, she begin dey feel well na im we waka go house. Later, di same sickness come back," na so Ochanya mama tok. Dem born Ochanya Ogbanje for 2005 and she bin dey live wit her parents and oda family members for Ogene-Amejo inside Benue state. She bi di last born of 11 children wey her parents born. She be five-years-old wen her mama, Rose and her papa Michael Ogbanje agree say e good make she go beta school- wey ...