JUSTIS FOR OCHANYA ELIZABETH OGBANYA


 TORI AS WE DEY WAKA COME: Di death of Young and promising Nigerian child 




Ochanya dey veri young wen she bin comot for her parent house.

Na school Ochanya find reach her aunty Felicia Ogbuja house and evritin first dey go on well for about four years until di mata begin take anoda turn.

Ochanya live wit di Ogbujas (Aunty Felicia plus her husband Andrew and five of dia pikin) for di same house for four years.


"Na for 2012, Ochanya sickness start. We carry am go hospital for Okpoga. Na for dia we stay reach about six days and she get medical attention. As time pass, she begin dey feel well na im we waka go house. Later, di same sickness come back," na so Ochanya mama tok.


Dem born Ochanya Ogbanje for 2005 and she bin dey live wit her parents and oda family members for Ogene-Amejo inside Benue state.

She bi di last born of 11 children wey her parents born. She be five-years-old wen her mama, Rose and her papa Michael Ogbanje agree say e good make she go beta school- wey make her go stay wit her aunty.

Ochanya mama na farmer and her papa don retire.




She be five years old wen she start to dey live wit di Ogbuja family for Benue State

Na Eight year old be her age, when dem rape am Sadly Ochanya bin later die sake of di several rape wey di culprits do to her.



Nigerians dey demand justice about seven years afta she die.

Her tori don begin dey cause serious tok-tok for social media since she die for October 2018, afta di tori waka come say dem rape her.


Plenty Nigerians don waka go social media to start di hashtag ##JusticeForOchanya to demand justice for di small girl.

Ochanya bin go live for her aunty house, Felicia Ogbuja wia she bin also dey go school.

She be five years old wen she start to dey live wit di Ogbuja family for Benue State, north central Nigeria. 

Di plan why she go live for dat house na to go school, according to one interview wey she grant tori pipo bifor she die.


Afta plenti request and petition, di police bin arrest Andrew Ogbuja for April 2018 on allegation of rape but dem no find im pikin, Victor dat time.

Andrew Ogbuja (husband to Ochanya aunty) bin face trial since 2019 for di Benue State High Court on charges wey surround alleged rape and culpable homicide. E say im no dey guilty.

Meanwhile, for anoda case against Felicia Ogbuja (Ochanya aunty), she bin face charges for negligence sake of say she allegedly fail to take action to stop the alleged sexual exploitation of di minor by her husband, and son, Victor.

Seven years afta di mata bin go viral for 2018, di mata don come up again.

Now for 2025, dem find di videos of one of di key suspects wey allegedly rape Ochanya wey police no arrest.

Victor Ogbuja na di son of Felicia Ogbuja (Ochanya aunty) wey allegedly rape her dat time, but police no arrest am or carry am go court.

Na as im video come dey show for social media wia e dey flaunt wealth, na from dia di fresh demand for justice for di death of Ochanya bin start again.

Plenti Nigerians including politicians and celebrities don chook mouth ontop dis mata.



Follow wakacometv on WhatsApp channel: https://whatsapp.com/channel/0029Va6GIeyGpLHVI3mOSf1D


For advert and sponsorship send E-mail to wakacometv@gmail.com As We Dey Waka, No Be Lie.

Comments

Popular posts from this blog

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.